Former Kano state govnor na APC new National Chairman

Plenty pipo don dey congratulate di immediate-past Govnor of Kano state, Abdullahi Ganduje afta im emergence as di National Chairman of Nigeria ruling party, di All Progressives Congress (APC).

Di National Executive Committee of di party elect Ganduje for di 12th NEC meeting wey hold on Thursday, 3 August for Abuja, di kontri capital.

Dem also elect former senate tok-tok pesin, Ajibola Basiru from Osun state as di National Secretary.

Dis development don make di former govnor become di 5th national leader of di party.

Im election dey come afta Abdullahi Adamu resign as di National Chairman for July 2023.

Di Deputy National Chairman (North) of party, Abubakar Kyari bin take ova di leadership of di party on acting basis afta e announce di resignation of Abdullahi Adamu.

Di new national chairman of di APC afta im emergence promise to ensure scientific registration of members of di party and pay attention to election management and conflict resolution.

E also say im go hit di ground running to ensure victory for di party for di forthcoming govnorship election across di kontri.

Who be Abdullahi Ganduje?

Dem born Abdullahi Umar for Ganduje village for Dawakin Tofa local goment for Kano state in 1949.

Ganduje bin start im education wit di study of di Quran and Islam and later study to Phd level.

E obtain im first degree by scholarship from Ahmadu Bello University Zaria for 1975.

In 1979, e complete im Master’s degree for Bayero University, Kano, and go back Ahmadu Bello University from 1984 to 1985 to study public administration.

In 1993, e receive im PhD from di University of Ibadan.

For im political career Ganduje bin join di NPN party for di second republic and e become di deputy secretary of Kano state from 1979 to 1980.

E run for di House of Representatives for 1979 under di NPN party, but e no win.

For 1998, e join di PDP wia e ask di party to nominate am for di governorship race, but e no succeed, instead dem nominate Rabiu Musa Kwankwaso.

But dem elect Ganduje as Kwankwaso deputy between 1999 and 2003, dem win di govnorship and deputy govnor elections for Kano again from 2011 to 2015.

For 2015, dem elect Abdullahi Umar Ganduje as govnor and e serve two times from 2015 to 2023.

Before im emergence as APC national chairmo, rumor bin spread say na im go replace Abdulahi Adamu.

Who be Surajudeen Basiru – APC National Secretary

Surajudeen Bashiru bin serve as senator wey represent Osun Central Senatorial District for di 9th National Assembly under di platform of di ruling All Progressives Congress.

E also double as di Chairman, Senate Committee on Media and Public Affairs at di time.

Dem born am on 1st of July, 1972 for Osogbo, Osun state for South-west Nigeria.

Basiru na legal practitioner by profession. Currently e be magistrate wit Osun state judiciary.