How Arsenal waya Chelsea 5-0 to retain top spot for di EPL table

Trossard score for Arsenal

Reuters

Chelsea bin dey without dia striker and highest goal-scorer Cole Palmer on Tuesday night as Arsenal waya dem 5-0 for di Emirates Stadium

Palmer currently dey injured and im fit play.

Di two rivals bin face diasef as Gunners bin get high hope to maintain dia Premier League lead while Chelsea bin dey struggle to come up di league table.

With dis win, Arsenal go three points clear on top of di Premier League.

Havertz and White both score twice during di game wey di Gunners dominate.

Arsenal score four times inside di ogbonge 18-minute game for di second half.

Di table as e stand now na: Arsenal (77 pts), Liverpool (74 pts), Man City (73 pts),

Di game as e bin happun live

Second Half

97mins: Di gunners fans dey happy.

SECOND HALF END

96mins: How Marinelli take lose dat one on one? What a bad miss for Arsenal

92mins: Arsenal still dey hungry for goal. Marinelli and Rice dey try create chances

SEVEN MINS OF ADDED TIME

90mins: Martineliiiiiiiiiiiiiiii,oh what a miss. Di ball go across di post.

89mins: Gabriel Jesus dey frustrated as di ball comot im leg. Odegard and Jesus dey square play for Chelsea box

87mins: Arsenal still dey make efforts for goal but Chelsea dey block dem. Arsenal moving in into Chelsea box.

Veira try longgggggg shot but e miss

83mins: Chelsea still dey find one single goal but dem neva see.

81mins: Saka don comot for game as Veira replace am.

80mins: Arsenal dey jolly and dey try push Chelsea go dia box. Rice get di ball to square play wit im oda players but no fit convert am to goal

78mins: Madeleine don comot for Chelsea as Arsenal continue to dey hold possession

76mins: Incredible play by Chelsea. Dem get throw-in. Jackson wan attempt to dribble but e go outside play

Arsenal 5 – 0 Chelsea

74mins: Chelsea dey pull some stunts but dem no fit convert am to goal

SUBSTITUTION

Partey out, Martinelli in. Trossard also out.

73mins: Arsenal dey put more pressure

70 mims: GOAL!

Ben White score brace.

69mins: Arsenal dey put pressure

67mins: Sterling take di free kick but e no strong as Arsenal keeper stop am

66mins: Chalobaoh enter for Chelsea

65′ GOAL!

Havertz score again for di gunners!

61′ Nicolas Jackson only get keeper to beat from a difficult angle, but e hit di side-netting rather dan shooting across di goal.

57′ GOAL!

Another goal for di Gunners, dis time by Havertz.

52′Goal!

Goal! Ben White of Arsenal fires di rebound into di bottom left corner afta di ball breaks to am for di box.

52′ Declan Rice of Arsenal collect pass from di flank, im look up come fire a goal-bound shot from di edge of di box defender push am to safety.

51′ Bukayo Saka of Arsenal work di corner short instead of sending di ball into di penalty area.

46′ Referee don blow whistle and second half don start

Arsenal 1 vs 0 Chelsea

FIRST HALF END

45mins: Trossard and Arteta don chop yellow card oooooo.

43mins: Cucurella dey down from Trossard foul. Na Tomiyasu side Chelsea player wan dey pass enta net oooo.

42mins: Cucurella don chop yellow card.

41mins: Jackson almost score… but di goalkeeper push am comot.

Arsenal 1 vs 0 Chelsea

36mins: Cucurella don do foul but im wan use strong head. Throw-in for Arsenal.

32mins: Corner for Arsenal. Di gunners dey get plenti chances. Saka long shot no enta net, na ova di bar.

31mins: Saka don do wicked for Chelsea defender. Odegard lose di ball against Chelsea players. But di ball still dey in play…

29mins: Cucurella dey Arsenal box. What a shot!!!! but e miss am.

27mins: Saka wan finish Chelsea defenders. Different shots from angle.

25mins: Should dat be a goal? Chelsea keeper no gree. im dey save many shots from Saka and Odegard.

Sakaaaaaa. Oh, di keeper catch am

25mins: Be like say Arsenal dey jolly for Chelsea box.

Corner for Chelsea but e go ova di head of players.

23mins: Jackson carry ball run ooooo. But e hit bar as Arsenal keeper siddown for floor.

22mins: What a miss!!!! Arsenal dey prepared for dis game.

21mins: See shot by Declan rice but e go ova di bar.

19mins: Declan Rice and Trossard dey square play for Chelsea box.

15mins: Chelsea don dey try enta Arsenal net but di defenders no gree..

14mins: Corner for Arsenal. Arsenal dey really put pressure ontop Chelsea..

10mins; Havertz miss di goal oooo

8mins: Pressure don dey enta di match. Jackson commit foul.

Arsenal 1 vs 0 Chelsea

Trossard give Arsenal dia lead.

3mins: GOAAAAALLLLLLLLL

Haaaaaaaaa na offside ooo. HavertZ dey run wit di ball bifor im fall.

Omins: Di match don begin wit a good kick. Let’s gooooooooooo

Palmer currently dey injured and im no go fit play.

Getty Images

Line-up

Collage foto of Arsenal player Bukayo Saka and Chelsea Cole Palmer

Getty Images

Chelsea

Petrovic, Gilchrist, Disasi, Badiashile, Cucurella, Enzo, Caicedo, Madueke, Gallagher (c), Mudryk, Jackson

Substitutes: Bettinelli, Chalobah, Thiago Silva, Casadei, Chukwuemeka, Dyer, Tauriainen, Sterling, Deivid

Arsenal

Raya, White, Saliba, Magalhaes, Tomiyasu, Odegaard (c), Rice, Partey, Saka, Havertz, Trossard

Substitutes: Ramsdale, Kiwior, Zinchenko, Jorginho, Vieira, Martinelli, Smith Rowe, Nketiah, Jesus

Arsenal and Chelsea facts

Before dis game, di only time wey Chelsea bin don win for di past nine times wey dem meet Arsenal for any competitions na August 2021 wey dem win 2-0 for Emirates stadium.

Di Blues bin dey fear to lose back to back Premier League away games against Arsenal for di first time since dem chop defeat from 2001 to 2003.

Arsenal

Di Gunners don win 12 of dia 16 Premier League home matches dis season but dis match fit decide if dem go lose consecutive top-flight home fixtures for di first time in two years.

Arsenal don win 11 of dia 13 league games for 2024- dem draw one and lose one.

Mikel Arteta side don keep 15 clean sheets for di league and five more dan any oda team.

Leandro Trossard don score career-best nine Premier League goals dis season.

Bukayo Saka penalty against Brighton na im only goal for six league appearances, as im don score seven for im previous six appearances di start of 2024.

Chelsea

Chelsea dey unbeaten for eight Premier League games, dem win four, draw four and dem dey score at least two goals for each of dia previous six appearances.

Di Blues don concede 27 Premier League away goals dis season and na dia highest afta 15 games since 1990-1991.

Chelsea don concede 52 league goals this season.

Dem don draw three consecutive Premier League away fixtures for di first time since September 2000.

Mauricio Pochettino neva win any away league game against Arsenal. Im draw four and lose three of im seven league visit to di Emirates Stadium.

Cole Palmer na di third player to score at least 20 goals for im first Premier League season for Chelsea after Jimmy Floyd Hasselbaink (23 in 2000-2001) and Diego Costa (20 in 2014-2015).

Source