Wetin New York Top court ruling wey overturn im 2020 rape conviction mean for Harvey Weinstein

Harvey Weinstein for court

Getty Images

New York top court don overturn Hollywood mogul Harvey Weinstein 2020 rape conviction, on di basis say e no receive a fair trial.

Di Court of Appeals see say prosecutors bin dey allowed to call witnesses wey dia accusations bin no dey part of di charges against am.

Di ruling say dat mean say dem try am on past behaviour and not solely on di crimes dem bin charge am with.

Weinstein, 72, go remain for prison for anoda separate conviction for rape.

Di court reach a 4-3 ruling on Thursday, say di trial “erroneously admit testimony of uncharged, alleged prior sexual acts against pesins oda dan di complainants of di underlying crimes.

“Di solution for dis errors na a new trial.”

One of di judges wey no agree however say with di decision, “dis Court continue to thwart di steady gains survivors of sexual violence don fight for, for our criminal justice system”.

Accusations against Weinstein begin for 2017 and spark di #MeToo movement, wey expose sexual abuse for di highest levels of di Hollywood film industry and beyond.

E bin face two trials: for New York, wia dem jail am for 23 years for 2020 for raping two women; and for California, wia dem sentence am to 16 years for raping one woman for Beverly Hills hotel.

Di California conviction no dey affected by di decision for New York.

Weinstein currently remain for one prison inside New York. Dem bin extradite am to LA to stand trial.

E go now dey up to Manhattan District Attorney Alvin Bragg, wey na im predecessor Cyrus Vance bring di case, to decide weda to retry Weinstein.

Source