No Champions League next year, almost all players dey for sale – Di worth of Man U squad

Manchester United

Getty Images

Manchester United don put almost all di players for dia squad up for sale.

Di club dey hope to refresh di team and generate moni under di new co-owner Ineos.

United bin don spend about £1bn to assemble dia current squad ova di past few years, but dem don endure disappointing season under Erik ten Hag.

Dis one wey dem no go play Champions League football next year, dem need to make beta use of player sales so dat dem go fit spend – na wetin BBC Sport chief football news writer Simon Stone tok as na wetin dem dey “poor at in di past”.

Manchester United most recent accounts show a total wage bill of £331m and average weekly wage for players of £154,000 – di two na di fourth-highest totals behind Man City, Chelsea and Liverpool.

So wetin be di value of dia squad? As eva wit football transfers, e depend on who crack di numbers.

BBC Sport work wit two respected football data and research providers CIES Football Observatory, external and Transfermarkt, external to calculate di approximate market value of di players wey dey Manchester United.

Rashford na di most valuable asset-CIES study

‘Three players wey get di biggest value downgrades’

To compare, Transfermarkt ‘market valuation’ dey much more modest, and dia UK content lead Stefan Bienkowski say dem consider factors such as form, age, contract status and dia own members evaluations.

Transfermarkt say three of di top five biggest downgrades for market value, external for di Premier League dis season na United Antony, Marcus Rashford and Mason Mount.

See dia valuations

Marcus Rashford, 26

“Afta im reach a career high of £73m for December 2021, Marcus Rashford market value don dey decrease steadily.

E bin jump back up to £68m around March of last year, but poor performance don make im market value drop to wia e dey now wey be £51m.”

Antony, 24

“Wit a market value of £30m bifor, to im 95m euros (£81.3m) move to Man Utd, our data suggest say Man Utd significantly overpay for di Brazilian winger.

We bin adjust di market value of di player to £64m afta im move, but im consistent poor performances don make am tumble back down, im don even go lower to £24m.”

Jadon Sancho, 24

“Sancho na one of di most valuable players for di world bifor, wen im value for market na £112m for 2020.

But afta im go Man Utd, im market value drop from £77m to £21m. Dis na sake of lack of game time or good performances.

If im get im form back wen im return to Dortmund, some potential bidders fit get interest and im market value fit rise bifor di end of di season.”

Bruno Fernandes, 29

“Di Portuguese midfielder still be one of Man Utd few consistent stars, na why im currently be dia most valuable player for £60m.

But wit im 30th birthday wey go soon reach, and im attacking stats wey dey slow down compared to im first few years for Old Trafford, Fernandes market value don start to crawl go down from a high of £77m.

E dey likely say no club fit dey willing to pay more dan £60m dis summer, even though di midfielder demand to comot from Old Trafford.”

Andre Onana, 28

“Dem sign am for 55m euros (£47.5m dat time), Onana bin get difficult start to life for Man Utd.

Although £34m dey like say e too low for a goalkeeper, Onana na di second most valuable shot-stopper for di world. No club don spend more dan 50m euros (£43m) on any keeper since 2018.”

Harry Maguire, 31

“Following im record £80m move from Leicester City, Maguire career bin go up for Transfermarkt market value of £60m.

But ova di past five years im dey struggle wit consistency and e be like say im be di best example of players wey Man Utd dey ovapay.

Im dey 31 years and wit im contract wey dey expire at di end of next season, market value of £17m for di England centre-half dey okay.”

Scott McTominay, 27

“Di Scotland international na veri useful player for Erik ten Hag team and im market value rise from £27m dis season.

Man Utd neva sell any central midfielder for more dan about £30m bifor, and e no dey clear if McTominay go push dat figure go up.”

Diogo Dalot, 25

“Dem sign am for £19m, Dalot market value dey rise steadily to £30m since im join di club for 2018.

Dis make am Transfermarkt eighth-most valuable player for Old Trafford and our eighth-most valuable right-back for di world.”

Source