Man City vs Chelsea FA Cup semi-final clash

Chelsea go face Man City

Getty Images

Di FA Cup semi-final between Manchester City and Chelsea go happun today for Wembley.

As e be, Chelsea go need prove demsef well sake of how dem no too dey beta position for di Premier league table.

Chelsea dey aim to reach di final of di FA Cup for di sixth time in eight seasons but dem need to beat Man City to achieve am.

Man City na di winner of last year FA Cup and dem dey look forward to beat Chelsea so dem go fit advance go di next stage.

Wen di match go happun?

Di match go start by 5:15pm WAT on Saturday as di two teams go show dia power ontop field.

Di two Premier League games wey don happun between Man City and Chelsea dis season don produce 10 goals but nobody win. Di two matches bin end for draw.

If dis game bin end for draw afta 90 minutes, dem go need go for extra time wey go decide di winner and even reach penalties.

Di final of di FA Cup go take place for Wembley on 25 May.

Man City vs Chelsea team news

Chelsea don win FA Cup eight times

Getty Images

Chelsea

Na since 1915 Chelsea bin become di first Football League from London to reach di FA Cup final. E don reach plenti years later, and na still Chelsea be di last hope to bring di cup back to London again.

Chelsea coach Mauricio Pochettino go want make im side beat di current title holders.

Chelsea even get five days to prepare for dis fixture but Man City bin play 120 minutes against Real madrid for di Champions League quarter-finals on Wednesday evening.

Na through penalties Man City bin take lose comot for di game afta Antonio Rudiger bin score di decisive spot kick for Etihad Stadium.

Pep Guardiola and im side neva progress from four of dia previous six FA Cup semi-finals.

For 2021, Man city bin lose to Chelsea for di FA Cup semi-finals including losing to oda London clubs.

Chelsea wey be say na 2018 dem lift dia 8th FA Cup go wan try to reach anoda final.

Cole Palmer na one Chelsea player wey dey use goals do wonder for di club. Im don score eleven goals for im previous six matches, including one against Leicester for di FA Cup quarter-finals.

Man City

Afta Man City bin face Real Madrid for Etihad stadium on Wednesday night, eight of dia players don play pass 3,000 minutes for all competitons dis season but na only four Chelsea players don reach dat number.

Guardiola tok say Erling Haaland, Kevin De Bruyne and Manuel Akanji bin ask make dem comot for dia last game but di coach no comot dem.

Wetin Guardiola dey do pass na to use attacking style by switching im key players wey go fit create some chances. Phil Foden na one correct player wey dey create chances and dey score well well.

Most FA Cup wins

14 – Arsenal

12 – Manchester Utd

8 – Chelsea, Liverpool, Tottenham

7 – Aston Villa, Manchester City

Chelsea vs Man City live updates

We go bring una live text updates of how di match go happun between di two strong teams.

Source