Iran vs Israel: Who get firepower pass?

Iran Supreme Leader, Ali Khamenei and Israel Prime Minister, Benjamin Netnayahu

Getty Images

One Israeli missile don hit Iran, US officials tell BBC Partner station CBS News.

Pipo hear explosions for di central province of Isfahan, even though e neva clear wetin dem target.

Iran dey on high alert afta Israel say dem go respond to di Iranian attack against am on Saturday night wia dem fire ova 300 drones and missiles for dia first eva attack on Israel.

Iran tori pipo neva report any direct impact from di Friday Israel strike as di International Atomic Energy Agency (IAEA) say dem no damage any nuclear sites. Israel too neva tok anytin offcially.

Isfahan, di province wia dem hear di blasts, get large airbase, major missile production and several nuclear facilities.

Iran semi-official Fars news agency wey dey close to di Islamic Revolution Guard Corps (IRGC) say dem hear di explosions near di Isfahan International Airport and one army base for Isfahan city, wey make di local air defence systems to activate.

Dis na afta Iran Deputy Foreign Minister, Ali Bagheri Kani, bin tell state TV say na seconds not hours dem go take ansa Israeli attack.

Israeli army chief of staff Lt Colonel Herzei Halevi bin tok say im kontri go do dia own back, afta Iran attack on 13 April.

Dis na ogbonge point for wetin di two kontris bin dey do wey dem call shadow war wey mean say na groups wey be paddy-paddy wit Iran dey attack Israel and strikes on Iran-linked targets dey widely blamed on Israel.

Israel already get hand inside di war for Gaza and dey face increase in cross-border fighting wit di Lebanese group wey dem dey call Hezbollah so any oda kasala fit cause risks.

Iranian missiles dey on display

Getty Images
Iran missile capability na one main part of dia military power

Which side carry pass for di weapons department?

Di BBC don measure dis question wit di sources wey dey listed under, even though each kontri fit get ogbonge weapons wey dem dey hide.

Di International Institute for Strategic Studies (IISS) don compare di firepower wey di two kontri militaries dem get, wit plenti official and open source methods to take get di best estimates wey dem fit make.

Oda joinbodi like di Stockholm International Peace Research Institute don also do dia own analysis but di accuracy fit dey different for kontris wey no dey too drop numbers like dat.

But, Nicholas Marsh, wey come from di Peace Research Institute Oslo (PRIO) say di IISS dey seen as di standard for assessing di military strength for kontris worldwide.

Israel and Iran population, Gross Domestic Product (GDP), defence budget and defence as a proportion of GDP (4% for israel and 2% for Iran) graph

BBC

IISS say Israel dey spend more for dia defence budget dan Iran, wey go give dem ogbonge strength for any kain kasala wey wan burst.

IISS say Iran defence budget dey around $7.4bn for 2022 and 2023, while Israel budget na ova times two of dat for around $19bn Israel defence spending wen dem compare am to di Gross Domestic Product wey be measure of im economic output also be double of Iran own.

F-35 plane

Getty Images
Di F-35 na one of di most advanced aircraft for di world

Technological advantage

IISS figures show say Israel get 340 military aircraft wey dey ready for fight, wey give am edge for precision airstrikes.

Among di jets dem get na F-15 planes wey get long distance strike range, F-35s – wey be high tech “stealth” planes wey fit hide from radar and fast attack helicopters.

IISS estimate say Iran get around 320 aircrafts wey reach to fight. Di jets na from as far back as di 1960s and dem include F-4s, F-5s, and F-14s (dat last one na di plane wey di 1986 feem Top Gun bin make popular).

But Nicholas Marsh from PRIO say e no clear how many of dis old planes dem fit fly, bicos to find spare parts for dem go hard no be small.

The F-14 dey featured for di 1986 movie Top Gun

Getty Images
Di US Navy comot di F-14 Tomcat from operation almost 20 years ago but e still dey in service for Iran

Iron Dome and Arrow

Di koko of Israel defence na dia Iron Dome and Arrow systems.

Missile engineer Uzi Rubin na di founder of di Israel Missile Defense Organization for di kontri Ministry of Defense.

Now e be senior researcher for di Jerusalem Institute for Strategy and Security. E tell BBC how “safe” e bin feel wen e see di Iron Dome and paddy paddy dem wey destroy almost all of di missiles and drones wey Iran fire give Israel on Saturday.

“I bin feel very satisfied and very happy… E dey specialised against im targets. Na short range missile defence. No oda system dey wey be like am at all.”

Anti-attack missiles fired above Israel

Amir Cohen / Reuters
Israel Iron Dome missile defence system bin help destroy di ova 300 missiles and drones wey Iran bin fire for weekend

Wetin be di distance between Iran and Israel?

Israel dey ova 2,100km from Iran. Im missiles na di main way wey e fit hit di kontri, na wetin Defence Eye editor, Tim Ripley tell BBC.

Map showing Iran, Israel and neighbouring kontries

BBC

Iran missile programme na wetin dey seen as di largest and most diverse for di Middle East.

For 2022, General Kenneth McKenzie from di US Central Command say Iran get “more dan 3,000” ballistic missiles.

According to di CSIS Missile Defense Project, Israel dey also export missiles to plenti kontris.

Iranian missile or drone wey dem fire Israel

EPA
Iran bin fire ova 300 missiles and drones sama Israel for Saturday 13 April

Iran missiles and drones

Iran bin do plenti work on dia missiles systems and drones since dia war wit Iraq from 1980 to 1988.

Dem don develop short and long range missiles and drones, plenti of dem na im dem recently fire Israel.

Analysts wey dey study missiles wey dey targeted at Saudi Arabia by Houthi rebels don conclude say na for Iran dem make dem.

Iranian consulate building in rubble

Reuters
Airstrike for 1 April scata one Iranian consulate building in Syria wey kill senior Iranian military personnel

‘Punish’ through long-range attack

Defence Eye Tim Ripley say im doubt say Israel go run ground battle wit Iran. “Israel big advantage na im air power and im guided weapons. So e get potential to launch airstrikes against key targets for Iran.”

Ripley say Israel go likely kill officials and spoil oil installations from di air.

“To ‘punish’ na di koko… Israeli military and political leaders dey use dat word evritime. Na part of dia philosophy, say dem go use pain take make dia opposition tink twice about dia opposition wit Israel.”

Before, dem don kill high-profile Iranian military and civilian pipo wit airstrikes, dis include di 1 April destruction of one Iranian consulate building for di Syrian capital, wey ginger Iran attack.

Israel neva claim responsibility for am or any number of attacks wey target ogbonge Iranian officials.

But dem neva deny responsibility too.

Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) Navy's speedboats move during an exercise in Abu Musa Island, in this picture obtained on 2 August 2023

IRGC handout / Reuters
Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) Navy speedboats during one exercise for Abu Musa Island

Naval forces

Iran ageing navy get about 220 ships while Israel get like 60, according to IISS reports.

Man dey paddle in front of a German-made Sa'ar 6-class corvette of di Israeli navy wey dock for di Red Sea port city of Eilat on 16 April 2024

EPA
IISS say di Israeli navy get about 60 ships

Cyber attacks

Israel get more to lose dan Iran for cyber attack.

Iran defence system no dey as technological advanced as Israel, so electronic assault on Israel military fit achieve ogbonge tins.

Di Israeli government National Cyber Directorate say, “di power of cyber attacks dey higher dan ever before, at least e dey three times higher, wit attacks for evri Israeli sector. Di collabo between Iran and Hezbollah (wey be Lebanese militant and political organisation) rise during di war.”

Dem report say 3,380 cyber attacks bin happun between di 7 October attacks and di end of 2023.

Di oga of Iran Civil Defense Organization, Brigadier General Gholamreza Jalali say Iran stop almost 200 cyber-attacks in di months before di parliamentary elections.

For December, Iran Oil Minister, Javad Owji, tok say one cyber attack bin cause wahala for petrol station all ova di kontri.

Di Iranian president for 2008, Mahmoud Ahmadinejad (centre) visit di Natanz uranium enrichment facilities for 8 April 2008 300 km south of Tehran -  Ahmadinejad announce for Iranian state television during di visit say Iran begin di installation of 6,000 new centrifuges, adding to di 3,000 centrifuges wey already dey di facility

Iranian government / Getty Images
For 2008, di former Iranian President Mahmoud Ahmadinejad announce say dem go increase production of uranium for di nuclear plant for Natanz

Nuclear threat

Sabi pipo tink say Israel get dia own nuclear weapons but dia official policy na to deliberately unclear about am.

Sabi pipo no reason say Iran get nuclear weapons even though dem don get accuse say dem get. But dem deny say dem wan use civillian nuclear programme take turn nuclear armed state.

One ballistic missile with one man standing next to am - di missile dey almost as wide as am

Reuters
Ballistic missile dey lie down for di shore of di Dead Sea, afta Iran bin launch drones and missiles towards Israel on Saturday

Geography and demographics

Iran na bigger kontri by far dan Israel and dia population of almost 89 million dey almost ten times bigger than Israel almost 10 million pipo.

Dem get about six times di number of serving sojas for Israel. Iran get at least 600,000 acting sojas while Israel get 170,000, na wetin IISS tok.

Remains of a drone

Getty Images
Di US don accuse Iran say dem dey give di Houthi rebels for Yemen drones

‘Iran card’

Middle East Affairs sabi pesin Tariq Sulaiman tell BBC Urdu say e believe say possibility low say dis war go increase more.

But e warn say pro war members dey di Israel parliament and cabinet wey want war and dey ginger Israel Prime minister to do sometin. “Whenever Netanyahu see say e dey politically at risk, e go use di Iran card straight.”

Poll wey di Hebrew University do show say almost three-quarters of di Israeli public no want Israel to attack Iran back if dat kain tin fit affect Israel security alliance wit allies.

One university statement say di survey bin happun for 14 and 15 April through internet and phone and sample 1,466 men and women wey represent adult Israelis wey get both Jews and Arabs.

Armed Houthi rebels open di door for deck of one ship

Getty Images
Houthi fighters hijack one British-owned and Japanese-operated ship for di Red Sea on 19 November 2023

Wetin be Israel and Iran ‘proxy war’

Although Israel and Iran never fight any formal war to date, both kontries don dey inside unofficial conflict. Dem dey kill important Iranian figures for oda kontries inside attacks widely blamed on Israel, including for Iran, while Iran dey target Israel through im paddy-paddy dem.

Di militant and political group Hezbollah dey fight di largest of Iran proxy wars against Israel from Lebanon. Iran no deny supporting Hezbollah.

Im support for Hamas for Gaza dey similar. Hamas mount di 7 October attacks on Israel, and don fire rockets from di Gaza Strip into Israeli territories for decades.

Israel and Western powers believe say Iran dey provide arms, ammunition, and training to Hamas.

Houthis for Yemen dey widely seen as anoda Iranian agent. Saudi Arabia say di Houthi missiles wey dem fire dem na made in Iran.

Iran-backed groups get ogbonge power for Iraq and Syria too. Iran dey support di Syrian goment and tori be say dem dey use Syrian territory to attack Israel.

Additional reporting by Ahmen Khawaja, Carla Rosch and Reza Sabeti and Chris Partridge

Source