‘Na pikin wey dey well loved and hardworking’ – Nigeria goment, family and friends mourn victim of London sword attack

Nigeria goment don react to di death of Daniel Anjorin, one 14-year-old boy wey die during one sword attack for London, United Kingdom.

One suspect, Marcus Arduini Monzo wey don dey police custody bin attack and stab di 14-year-old for inside im school uniform, plus three oda pipo wey include two police officers for Hainault on Tuesday, 29 April.

Di young boy wey be British-Nigerian bin die for hospital and di odas dey seriously injured.

Di Chairman of Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom), Abike Dabiri-Erewa, don tok sorry to di family of Daniel Anjorin on im death.

For inside statement wey di commission head of media Abdur-Rahman Balogun sign, e say di incident dey veri “unfortunate, sad and horrible”.

Nidcom add say dem go make sure say di suspect wey don already dey police custody dey punished accordingly.

How di sword attack take happun

Man wit sword

BBC

Na on Tuesday morning, during rush hour and wen pipo dey rush carry dia children go school di attack happun.

Police say dem receive reports around 07:00am say one car drive enta one house on Thurlow Gardens, near Hainault Tube station for north-east London and one pesin come out begin stab pipo.

Witnesses bin capture di footage of one man wey dey scata di area wit one samurai-style sword.

Witnesses wey describe di incident say di man hold one “huge sword” and dem hear as e dey shout.

However, five pipo injure for di attack including 14-year-old Daniel Anjorin, two men aged 33 and 35, plus two police officers.

Daniel bin dey go school wen di suspect attack am and e suffer fatal stab wound bifor e later die.

Aiste Dabasinskaite, Daniel neighbour wey follow Press Association (PA) tok say: “We bin dey shout and wave towards Daniel as e come out. E get headphones on im ears so e no fit hear us. E just happun right bifor our eyes, e dey horrible.”

Another neighbour say im no fit sleep for night again “becos all I dey see na di man as e stand dia wit di sword”.

Video wey dey spread on social media show as di man dey wield sword and enta pipo house – oda footage show as police dey pursue one man as e run enta pipo gardens.

Marcus Monzo dey court ova death of schoolboy for Hainault

Met Police don arrest 36-year-old Marcus Arduini Monzo for di Hainault attack.

Dem charge am wit two counts of attempted murder, two counts of causing grievous bodily harm, aggravated burglary, and possession of a bladed article.

Mr Monzo bin appear for one court for London on Thursday and court rule say make e still dey police custody till di next hearing.

Mr Monzo, na from Newham, east London. Di dual Spanish-Brazilian national bin stand for di dock, e wear one grey tracksuit and hold im left arm across im chest.

E bin tok slowly wen e tok im name give di court. E go appear again for Old Bailey on 7 May if hearing no dey available on Friday, di chief magistrate, Paul Goldspring, tok.

Authority tok say all di alleged offences bin happun for Laing Close, apart from di offence of GBH wey dem allege say take place for Franklyn Gardens nearby.

Di court hear say Mr Monzo bin crash one van enta inside one fence at about 07:00 BST on Tuesday, e jam one pesin.

E comot from di van, and say im go kill di man and cut im neck, di court hear.

Prosecutor David Burns bin tell di court say Mr Monzo enta inside one nearby house wia di couple bin dey sleep wit dia four-year-old daughter.

E allegedly enta di bedroom and attack di child father, e dey shout say im believe in God as e injure am for im neck and arm, di court hear.

Di prosecutor accuse Mr Monzo say e run up behind Daniel, wey dey waka go school, and attack am before e stab am for chest as e lie down for ground.

Di court hear say police officers bin arrive di scene to try help di teenager, but Monzo bin appear from bush. Officers later chase am.

Di court hear say e jump on top one female officer and attack her wit di sword as she dey on di ground.

E also dey accused of injuring a second officer wey suffer arm wounds.

‘E bring im family lots of joy’

Flowers wit one note say 'RIP little angel'

PA Media
Well-wishers don dey lay flowers

Daniel family say e be wonderful child wey dey “well loved” and “hard working”.

“No family should gatz go through wetin we dey experience,” dem tok. “Any family go understand say dis na absolute tragedy.”

Daniel Anjorin na pupil of Bancroft’s School for Woodford Green.

Im school say Daniel na “true scholar” wey get “positive nature and gentle character”.

For inside statement, di school management describe am as a “core member” of di community, dem add say: “Losing such a young pupil na something we go always struggle to come to terms wit.”

One fundraising page, wey one friend to Daniel brother set up on Wednesday, don already raise £25,000.

Jubilee Church, wey Daniel bin dey attend don express dia “immense sadness” for di “sudden and tragic death”.

Janti Charalambous, wey im son dey attend Snaresbrook Prep School wit Daniel tok “Daniel na amazing young man.

“E dey good at im studies. E dey good for sports. Na pesin wey many, many pipo love and e come from a wonderful family.

“Di family dey for shock. Obviously dem dey very heartbroken. Na young boy e be and dem take am away from im family.

“E dey sad say dis kain thing happun for one family, for community, like dis. E dey heart-breaking.

Members of di community dey pay dia last respect for Hainault

PA Media
Members of di community dey pay dia last respect for Hainault

Dis attack dey come few months afta di Knife attack for Nottingham wey lead to di death of 19-year-old Grace O’Malley-Kumar.

Grace wey be student of University of Nottingham and her friend Mr Webber, bin dey waka go dia student accommodation afta end-of-term night-out wen demfattaly stab dem for Ilkeston Road just afta 04:00 BST on 13 June.

Meanwhile for Hainault, police don lift di cordon dem take seal di scene and pipo don lay floral tributes for there.

Sue, one retired minister, dey among those wey pay dia last respects.

She say: “e dey lovely di way dis community for here take dey support and care for one another.

“We just hope and pray something like dis no go ever happun again for here.”

Source