Man Utd vs Arsenal: Team news and all you need to know

Collage of Man Utd players and Arsenal

Getty Images

Manchester United go host Arsenal for Old Trafford to battle out dia position for di English Premier League table.

Dis no be di first time wey di two teams go meet but dis game go determine a lot of tins for di Premier League.

For September 2023, Arsenal beat Man United 3-1 for di Premier League game but how strong dem go dey to recreate anoda win?

Arsenal currently dey second position for di league table and dia win go put dem ahead of dia title contender Manchester City.

If Man United win, dem go also move up di league table to fight for a place for European football next season.

Arsenal and Man United don meet about 200 times – out of dat, Man United don win 84 games and Arsenal win 69 games while dem draw 47 times.

Mikel Arteta wey dey coach Arsenal sayim dey dream of di time wey im team go lift di Premier League trophy.

Man United players celebrating dia goal

Getty Images
Man United players celebrating dia goal

Team news

Man United

Bruno Fernandes and Scott McTominay don come back to join di Manchester United team afta dem miss di 4-0 defeat against Crystal Palace last Monday.

Marcus Rashford suppose dey available afta im dey absent for three match but Mason Mount go still miss out for dis game against Arsenal afta im sustain anoda injury.

Arsenal

Arsenal get fitness concerns ova Bukayo Saka and Takehiro Tomiyasu. If di two of dem dey available e go mean say manager Arteta fit name di same starting 11 for di fourth match in a row.

Jurrien Timber fit return to di squad for di first time since im suffer a serious knee injury for di opening weekend of di season.

Match facts between Man United and Arsenal

Arsenal players dey celebrate a goal for dia last match

Getty Images
Bukayo Saka celebrating goal wit im teammate

Head-to-head

Manchester United defeat for dia past 16 home league games against Arsenal na 1-0 for November 2020.

Di Gunners bin win dia September 2023 fixture 3-1 sake of di of stoppage-time goals from Declan Rice and Gabriel Jesus.

Arsenal last six league away wins versus Manchester United na all by a 1-0 scoreline.

Manchester United

Manchester United don chop beating for 18 of dia 48 matches dis season. Dem neva lose 19 in a single campaign since 1977-1978 season.

But wetin go happun for dis season?

Di last time Man United finish on 13th position – outside of top seven, na 1989/1990 season wia dem lose 16 games.

Di Red Devils don concede 81 goals in all competitions.

Wetin go happun against Arsenal today go determine if dem go suffer a club record-equalling ninth home defeat of di season for di first time in 50 years.

Marcus Rashford dey involved in six goals for im last four Premier League starts against Arsenal wia im score four and assist two.

Arsenal

Arsenal fit set an outright club record on Sunday of 27 winning in a 38-match league season.

Dia only points wey dem drop for di 16 Premier League fixtures in 2024 na from di 0-0 draw for Manchester City on 31 March and a 2-0 home defeat versus Aston Villa last month.

Di Gunners dey unbeaten in eight away league games – winning seven – for di first time since wen dem win 12 unbeaten from March to December 2016 under Arsene Wenger.

Arteta side don keep 10 clean sheets in top-flight away matches dis season.

Arsenal don score 88 league goals dis season- a record wey dem neva beat six years wen dem finish wit 90 goals.

However, dem don win only one of dia six away league games for di current campaign against di oda teams wey currently dey di top eight.

Dem win 3-2 against Tottenham on 28 April.

Di Gunners don lose dia final Premier League away fixture for three of di last four seasons without scoring.

‘I no regret to coach dis team’- Ten Hag

Manchester United manager Erik ten Hag say im no regret to take di job as coach even wen di club dey go through current problems.

Ten Hag still get one year left for im contract wit Man United but serious pressure dey ontop am sake of di humiliating outing of di team dis season, especially di last 4-0 defeat against Crystal Palace.

“I no regret to come here for one second. Dis na massive club, you no fit know di challenges wey you go face until you dey inside am but I bin want dis challenge.”

Man United currently dey eight position for di League table and dem dey ready to face Arsenal for dia Sunday match.

Source