England vs Switzerland match preview

England match

Getty Images

England fit line up wit a back three against Switzerland wen dem jam for dia Euro 2024 quater-final wey you fit watch live for BBC.

Oga Gareth Southgate fit do change of system afta im set up im side wit four man defence for Germany, even though im tok say dem don hammer am say im use dat syatem bifor.

Plenty reasons dey why Southgate fit dey reason dat option: like underwhelming performances, suspensions and di want ot match di Swiss man for man.

Even though to change formation for di middle of tournament like dis dey radical for am, dis England manager get experience wit playing back three.

Di match go be Southgate 100 game as England coach. In di last games dem don play e don use back three or back five for 33 matches.

England bin play di three for back formation for im first main tournament in charge wey be di 2018 World Cup wey dem come number four position.

Di exact line up wey Southgate dey use as England manager for XI wey start di four games for di tournament – against Tunisia for di opener and di three knockout matches against Colombia, Sweden and Croatia.

Southgate use back three or back five for 16 games between October 2017 and September 2018. E use di system till wen dem win Switzerland 1-0 for friendly match.

Since den Southgate dey normally go wit 4-3-3 formation except for a few times. England bin play di 3-4-2-1 for dia 2020 Nations League run but wen dem lose to Denmartk and Belgium dem about turn back to di back four or di next year European Championship.

Dem also use am for di last two group games for di 2022 Nations League but Southgate start to dey experiment wit oda formations afta Hungary flog dem 4-0 for house.

Since di 3-3 draw wit Germany for September 2022, Southgate neva use dat formation for di last 23 games wey England don play recently. Dis include di back four throughout di 2022 World Cup for Qatar.

England win rate na 48.5% wit back three or back five wit Southgate as manager compared to di 60.5% win rate dem get overall.

Dis for explain how e ansa BBC Radio 5 Live about using di three man defence against di Swiss.

E add say, “e always be option, obviously option wey dem don hammer us for di past two years say we dey use. So e dey interesting say pipo dey tink say na wetin we suppose use now.”

Team News

Apart from say Guehi dey under suspension, England get all 26 players for Saturday and Southgate tell tori pipo on Friday sat Shaw dey “fit to start”.

Switzerland manager Yakin don confam say Granit Xhaka dey fit to face England for Dusseldorf even though im get adductor problem.

How you fit follow di match

Di match go play live for BBC One and BBC iPlayer from 16.00 BST on Saturday.

Live commentary go dey for BBC Radio 5 wit build up from Mark Chapman.

You fit follow live text coverage for di BBC website and app

Wetin you suppose know about di stats

  • Dis go be di fourth time England and Switzerland dey meet for major tournament, and di third time for di European Championship. England win 2-0 for di 1954 World Cup, 3-0 for Euro 2004 and draw 1-1 for Euro 96.
  • England don reach quarter finals or beta for all di four of dia major tournaments under Gareth Southgate, dis go be di first time wey dem don reach di last eight for di four consecutive Euros and World Cups.
  • Switzerland don reach dia fifth major tournament quater-final, and second for di European Championship, afta Euro 2020. Dem dey eliminated for dis stage for all dia four previous attempts, dis na di most time wey any European kontri go feature for quarter-finals of major competitions witout say dem enta semi-finals.
  • England don win 49 of dia 116 matches for major international competition and go be di sixth European kontri wey fo win 50 if dem win dis one. Di oda kontris na Germany, Italy, France, Spain and di Netherlands.
  • Switzerland seven goals for Euro 2024 don dey scored by seven different players.

Source