How Man United dey handle Erik ten Hag situation?

Erik Ten Hag

Getty Images

Manchester United go dey wit manager Erik ten Hag for dia match against Porto and Aston Villa dis week, despite dia defeat against Tottenham for Old Trafford on Sunday.

Ten Hag dey face a poor start to di season, im team dey 12 position for Premier League.

Some senior sources for Manchester United tell BBC Sport say na business as usual and add say di club dey focus on di upcoming matches against Porto and Villa. Di club neva make official comment on top dis mata.

Afta di 3-0 loss against Spurs Ten Hag say im “no dey think” about losing im job, im add say im and di owners dey “on di same page”.

Ten Hag bin sign new contract for summer and last month club chief executive Omar Berrada say di club dey support am.

While di pressure on Ten Hag dey mount, on Monday morning top pipo for di club tell BBC Sport say dem go always consider such situations carefully, instead of making decision immediately afta a bad result.

Ten Hag dey face important week wit trips to Porto for Europa League and Aston Villa for di Premier League bifor di October international break.

Joint-worst Premier League start

Erik ten Hag

Getty Images
Erik ten Hag side don win just three of nine matches for all competitions dis term

Afta Sir Jim Ratcliffe buy of a 27.7% stake for Manchester United, wetin happun next na complete change of di club board and interesting summer transfer window, many pipo bin dey look forward to di season wit plenty ginger.

But dat ginger don fade sharply and di stats afta six matches for Premier League dis season no be something wey go sweet Ten Hag:

  • Manchester United seven points na di club joint-fewest afta six games of a Premier League season.
  • Na only for 2007-08 season wey United bin score fewer goals for dia first six Premier League games.
  • United don lose back to back Premier League matches without scoring for Old Trafford for di first time since November 2021, na wetin be happun for Ole Gunnar Solskjaer final two home games in charge bifor im chop sack.
  • United now don lose more Premier League matches by three or more goals since Sir Alex Ferguson leave di club (23 in 424 games) dan dem bin do for dia 1,035 league games under di Scot (22).

In nine matches in all competitions so far dis season, United don win just three.

But if results bad, dia performances too no good.

Spurs created an xG (expected goals) of 4.67 during Sunday win, dat na di most di club don ever record in a single game for a Premier League season. In three Premier League home matches dis season, United don accumulate an xG of 4.84.

Last season many pipo bin dey tok about United leaky defence as di club concede 58 times for Premier League – dia most in a 38-match Premier League campaign.

Di Red Devils don keep clean sheets for half of dia league matches so far, as well as anoda for dia 7-0 win against Barnsley for EFL Cup.

But dem score just five league goals, wey help di club to a -3 goal difference.

No United player get more dan one league goal dis term, wit Marcus Rashford, Amad Diallo, Joshua Zirkzee, Matthijs de Ligt and Alejandro Garnacho all don score once.

Ineos and Ten Hag dey ‘on one page’

Wen Ratcliffe buy a stake for United last December, Im Ineos sports division take control of football operations.

Di 71-year-old bin make am clear afta im become minority owner say di club problems extend far beyond Ten Hag – or indeed any manager wey don come bifor am since 2013.

“For di last 11 years, Manchester United don get plenty coaches and none of dem dey very successful for dat environment,” Ratcliffe tell BBC Sport for February.

“Dat one tell me say something dey wrong wit di environment. E no dey constructive for me to blame anybody, Na just a fact. My focus na on how I fit change dat environment to get di best out of di coach and squad.”

An end-of-season review see United tok to a number of managers about replacing Ten Hag.

However, di club eventually decide to stay wit di Dutchman sake of di FA Cup final victory against Manchester City for May.

Dem give Ten Hag one new one-year deal to take am through to 2026, but di club change im backroom staff as Ruud van Nistelrooy and Rene Hake join to replace Steve McClaren, Benni McCarthy and Mitchell van der Gaag.

Di former Ajax boss insist afta Sunday defeat say di board dey support am and both parties dey aligned on how to move forward.

“All of us dey on one page togeda, di ownership, di leadership group, di staff and di players’ group as well. I no get any concern,” Im tok.

Ratcliffe, wey no bin dey present for di 3-0 defeat, instead im choose to watch im Ineos Britannia sailing team compete for di Louis Vuitton Cup for Barcelona, im neva speak about Ten Hag position so far dis season.

Berrada and Dan Ashworth, wey join as chief executive and sporting director respectively dis summer, both of dem don give dia support to Ten Hag.

“I feel say Erik na di right coach for us, we support am,” Berrada tok bifor di 3-0 defeat by Liverpool for September.

But, both Ashworth and Berrada make am clear say dem bin no dey part of di end-of-season review wey bin decide to retain Ten Hag.

Important week ahead

Dis no be di first time since im appointment, wey Ten Hag dey face important week in charge for Old Trafford.

United go travel to Porto for di Europa League on Thursday, afta dia draw against FC Twente for dia opening group stage fixture last week.

Di Red Devils go den visit Villa Park on Sunday to take on Unai Emery in-form Aston Villa for Premier League.

Dat fixture go be United last game for 13 days as di Premier League season go pause for di October international break.

Important week ahead

Dis no be di first time since im appointment, wey Ten Hag dey face important week in charge for Old Trafford.

United go travel to Porto for di Europa League on Thursday, afta dia draw against FC Twente for dia opening group stage fixture last week.

Di Red Devils go den visit Villa Park on Sunday to take on Unai Emery in-form Aston Villa for Premier League.

Dat fixture go be United last game for 13 days as di Premier League season go pause for di October international break.

Wetin United don do bifor for dis situation?

Supporters fit dey used to seeing United managers under pressure but di Red Devils now dey under new leadership.

Ineos bin inherit a difficult situation wen dem take control of football operations late for 2023.

Di board stick by Ten Hag throughout last season, even afta di 4-0 defeat by Crystal Palace for Selhurst Park for May.

But dem bin dey prepare for FA Cup final on the horizon and Ten Hag fit use last season injury crisis as major excuse for poor results.

Since Ferguson retirement for 2013, United dey used to giving managers time.

David Moyes bin chop sack only afta e become mathematically impossible for United to qualify for di Champions League for 2014.

Louis van Gaal collect im sack letter afta im win di FA Cup final for 2016, but di board stand by am during a poor mid-season run dat time wey see defeats by Bournemouth, Norwich City and Stoke City.

Jose Mourinho bin spend two-and-a-half seasons in charge, while Ole Gunnar Solskjaer bin stay for another month even afta a 5-0 home defeat by Liverpool for October 2021.

‘No sense of knee-jerk reaction’

Simon Stone, BBC Sport’s chief football news reporter

I dey call dis ‘tin hat time’.

Manchester United suffer a bad (really bad) result, evri body get opinion (negative) and di club dey find imsef under siege. Na time to put on di tin hats and ignore di noise.

Wetin dem go do?

I no feel say dem go take any confusing reaction. United wan show sense of calm.

But clearly Thursday trip to Porto and Sunday Premier League match for Aston Villa offer both opportunity to reset and chance say a rubbish situation fit worse.

Dis na old and familiar situation for Old Trafford. But di pipo in charge dey new. Dis na dia first big test since dem conclude say Ten Hag na di right man to stay in charge.

Leadership dey start at di top. Dis na di point wey action dey speak louder than words.

Source