Actress Dame Maggie Smith die at di age of 89

Actress Dame Maggie Smith

Getty Images

Actress Dame Maggie Smith, known for di Harry Potter feems and Downton Abbey, don die at di age of 89, her family announce.

Smith wey be legend of British stage and screen, bin win two Oscars during her career – for The Prime of Miss Jean Brodie for 1970 and California Suite for 1979.

She bin get four oda nominations, and receive eight Bafta awards.

For di Harry Potter feems, Dame Maggie play di role of Professor Minerva McGonagall, famous for her pointed witch hat and stern manner wit di young wizards for Hogwarts.

One statement from her sons, Toby Stephens and Chris Larkin say: “Na wit great sadness we gatz announce di death of Dame Maggie Smith.

“She bin pass away peacefully for hospital early dis morning, Friday 27th September. Intensely private pesin, she bin dey wit friends and family at di end. She leave two sons and five loving grandchildren wey dey devastated by di loss of dia extraordinary mother and grandmother.

“We go like to take dis opportunity to tank di wonderful staff at di Chelsea and Westminster Hospital for dia care and unstinting kindness during her final days.

“We tank you for all your kind messages and support and ask say make you respect our privacy at dis time.”

Hugh Bonneville, wey be fellow actor, pay tribute to Smith, and say: “Anyone wey eva share a scene wit Maggie go attest to her sharp eye, sharp wit and formidable talent.

“She be true legend of her generation and tankfully she go live on in so many magnificent screen performances. My condolences to her boys and wider family.”

Some of her oda most memorable roles include di 1985 Merchant Ivory feem A Room With a View, wia she bin play di chaperone Charlotte Barlett.

Di role bin win am her nominations for Oscar and Golden Globe.

Dame Maggie career begin for theatre, but she bin gain her first Bafta nomination for di 1958 melodrama, Nowhere to Go.

By 1963, dem offer am di part of Desdemona by Laurence Olivier, to star opposite im Othello, at di National Theatre, and two years later, dem make am into a feem wit di original cast, and dem nominate Smith for Oscar.

Source