‘I dey wrong, e no dey Bible’ – Pastor Adeboye apologise for past tithe comments

Di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God (RCCG) Pastor Enoch Adeboye wey popularly dey referred to as Daddy GO don tok sorry for one previous comment wey e make on tithing.

Di 82-year-old religious leader for one programme wit young adults and youths of di church say im make “mistake” wen e tell believers say if dem no pay tithe, dem fit no make heaven.

“I dey sorry for saying if you no pay tithe, you fit no make heaven, E dey wrong, E no dey for Bible,” Adeboye apologise.

E say wetin Bible tok na “be at peace wit all men and holiness without which no man shall see God.

Di respected senior pastor bin tok for 2020 during one of im sermons on tithe say, paying tithe na one of di tins believers fit do to make heaven.

“Anyone wey no pay tithe no go go heaven fullstop.” Adeboye bin tok.

For one recent sermon wit di church youth during dia October 2024 Youth Convention, di pastor wen e dey preach about “dominion” tok wetin youths fit do to dominate.

E say some of dem na to give God violent praise and violent tithe.

On tithe wey be controversial topic for di Christendom for Nigeria, e say very soon, im go come out tok to everybody as soon as God permit am on top di tithe mata.

E also clear am say e dey possible to dey right and wrong at di same time.

To shed more light on di tithing message, Pastor Adeboye say e dey wrong to limit believers to 10% wen some of dem suppose dey do 20%, 30%, 40%.

“10% suppose be for beginners. I believe God go give me opportunity very soon to give you di details.”

E say for anyone wey wan be at di top, anyone wey wan dey control finances, di pesin go go far beyond 10%. ” E dey wrong for me to tell you to do 10%.”

Source