Tributes pour in for ‘Special’ singer and actor Kris Kristofferson

Foto of Kris Kristofferson

Getty Images

Tributes don dey pour in for Kris Kristofferson, di award-winning country singer and actor afta im die at di age of 88.

World popular musician Dolly Parton write say “Wat a great loss. Wat a great writer. Wat a great actor. Wat a great friend.”

She end her post on social media wit di words “I go always love you”, wey be one of her most famous songs.

Anoda musician wey dey popular well well for di world, Barbra Streisand say “she bin know say im get sometin special” di first time she bin see am perform.

Kristofferson and Streisand bin share top billing for di 1976 remake of di feem A Star Is Born.

Kristofferson act wit Streisand for di 1976 version of A Star Is Born

Getty Images
Kristofferson act wit Streisand for di 1976 version of A Star Is Born

For di feem, dem bin sing togeda on love theme Evergreen, wey bin win Oscar award for best original song, and Kristofferson bin also win di Golden Globe for im acting.

Streisand bin also tell am to appear on stage wit her for London Hyde Park for 2019.

“Im bin dey as charming as ever, and di audience shower am wit applause. Belle bin sweet me as I see am receive di recognition and love wey im deserve well-well,” she write for Instagram.

Pipo sabi Kristofferson well-well for im songwriting, notably credit for Me and Bobby McGee, and Help Me Make It Through the Night, among odas.

“Im bodi of work wey bin give voice not only to im soul but to us too,” Na wetin Country Music Hall of Fame chief executive Kyle Young tok for statement.

‘Epic human’

Representative for Kristofferson tok say im die “peacefully” for im home for Hawaii on Saturday, and im family bin surround am.

Di statement describe Kristofferson as “a peacenik, a revolutionary, actor, superstar, a sex symbol, and a family man.”

One message from im family say dem bin dey “so blessed” for di time wey dem bin get wit am.

“Thank you for loving him all dis many years, and wen you see a rainbow, know say im dey smile down at us all,” di message tok.

Adding her tribute, singer LeAnn Rimes post foto of di two of dem wit di message: “Epic human wey get di biggest heart. We go miss you well-well Rest easy, my friend.”

Melissa Etheridge add say: “I bin love dis man, im talent, im mind and im beautiful heart.”

Reba McEntire write say: “Wat a gentleman, kind soul, and a lover of words. I dey happy say I bin meet am and be around am One of my favorite pipo. Rest in peace, Kris.”

Kristofferson (right) na one of di four members of The Highwaymen wit Willie Nelson, Waylon Jennings and Johnny Cash

Getty Images
Kristofferson (right) na one of di four members of The Highwaymen wit Willie Nelson, Waylon Jennings and Johnny Cash

Kris Kristofferson profile

Dem born am for Brownsville, Texas, on 22 June, 1936, Kristofferson become a leading figure for country music.

“Wen I bin start, I be one of di pipo wey bin dey hope to bring respect to country music,” im tok, according to di family message.

“Some of di songs I bin get wey become hits a wetin I do. I imagine say na why somebodi fit vote me into a Hall of Fame. I know say no be becos of my golden throat.”

Kristofferson bin study writing for Pomona College for California and later, im go Oxford as a Rhodes scholar.

Im get im masters from Oxford for 1960, den im go back to di US con join army.

Im work for di military na to teach literature, wey im tok say bin dey “sound like hell”.

For 1965 im bin visit Nashville, and within two weeks im resign from im army post con join country music hub to pursue im music career.

Di head of di Country Hall of Fame and Museum say im leave “a resounding legacy”.

“Kris Kristofferson bin believe say creativity na God-gift, and anybodi wey dey ignore such gift dey doomed to unhappiness,” Kyle Young write on X. “Im bin dey preach say a life of di mind dey give voice to di soul, and im work bin give voice not only to his soul but to our own.”

Im bin win three Grammys for best country song, Help Me Make It Through the Night for 1972, and two separate duets (collabo) wit Rita Coolidge (1974, 1976), wey im marry in di 1970s.

Kris Kristofferson bin dey perform for di Pyramid stage for Glastonbury for 2017

Getty Images
Kris Kristofferson bin dey perform for di Pyramid stage for Glastonbury for 2017

For im acting career im bin act plenti roles, including di Pat Garrett and Billy di Kid, Lone Star, and di Blade franchise.

Im bin also act as John Norman Howard for A Star Is Born opposite Streisand’s Ester Hoffman.

Dem bin nominate am for Oscar for 1985 for best original score for Songwriter, wey im act togeda wit Willie Nelson.

Di same year, Kristofferson and Nelson join friends Johnny Cash and Waylon Jennings to form one supergroup wey dem bin call The Highwaymen.

“Evri time wey a look any foto of Willie and me and John and Waylon, e dey sweet my belle say dem leave di cleaner for dia,” im bin tell journalist Mikal Gilmore, wen im bin dey make reference to im former job for di CBS’s Nashville studio.

For 2003, Kristofferson receive di Free Speech Award from di Americana Music Association.

A year later, im become di member of di Country Music Hall of Fame.

Im bin also receive multiple lifetime achievement honours, including The Recording Academy, di Country Music Association and di Academy of Country Music.

Kristofferson survive by im wife Lisa, his eight children, and seven grandchildren.

Source