Eid-el-Kabir celebration around di world in fotos as Muslim festival bring joy and unity

Eid Mubarak

Getty Images
Pipo dey celebrate afta di prayer of Eid Al-adha for Al Seddik Mosque for di Heliopolis area of Cairo, Egypt.

Muslim faithful around di world dey celebrate Eid-el-Kabir wey also dey known as Eid al-Adha or di Festival of Sacrifice.

Na one of di most important Islamic holidays. E dey commemorate di willingness of Prophet Ibrahim (Abraham) to sacrifice im son Ismail (Ishmael) as act of obedience to Allah command. However, Allah bin provide one ram for di sacrifice instead.

Dem dey celebrate di festival wit special prayers, feasting, and di ritual slaughter of animals such as sheep, goats, cows, or camels.

Di meat from di sacrificed animals dey distributed among family, friends, and di less privileged, and e dey symbolise di importance of charity, community, and obedience to God.

Dem dey celebrate Eid-el-Kabir on di 10th day of Dhu al-Hijjah, di last month of di Islamic lunar calendar, and e dey coincide wit di completion of di Hajj pilgrimage to Mecca.

As dis celebration dey shele, dis na some beautiful fotos wey capture di joy and unity di festival dey bring.

Eid-el Adha

Getty Images
Muslims perform di Eid al-Adha morning prayer around di Kaaba, Islam holiest shrine, for Grand Mosque for Saudi Arabia holy city of Mecca.
Eid Mubarak

Getty Images
Muslims perform Eid al-Adha prayers at Amr bin Al-Aas Mosque
Eid Mubarak

Getty Images
Children celebrate wit balloons afta dem perform di Eid al-Adha morning prayer for di Education City Stadium for Doha, Qatar
Eid Mubarak

Getty Images
Muslims celebrate afta Eid al-Adha prayers for di Abu Bakr al-Siddiq Mosque for Heliopolis, Cairo, Egypt.
Eid-el Adha

Getty Images
Young girls wey wear traditional outfits fly balloons as Muslims gada for di Al-Aqsa mosques compound for Jerusalem to mark Eid-el-Adha

Bola Tinubu Eid-el-Kabir message

President Bola Tinubu on Sunday tok say Nigeria need citizens wey fit sacrifice to fulfil di dreams of dia founding fathers.

Di president yarn dis one wen im address tori pipo afta im observe di 2024 Eid-el-Kabir prayers for Dodan Barracks, Lagos.

E say pipo gatz follow di path of sacrifice to make Nigeria great.

“To be veri good citizen come wit responsibility. As citizens, wetin you go do to be a very committed member of our society? Go and sacrifice. Love your kontri, love your neighbours, share wetin you get wit one anoda and dey tankful to Almighty God. Na all be dat,” President Tinubu tok.

Former Nigeria president Muhammadu Buhari don encourage Nigerians to look out for one anoda.

Buhari say im dey happy as more Nigerians don begin farm to grow more food so dat prices go reduce and di nation go fit chop well.

“I use dis occasion to beg all citizens to make Nigeria self-reliant. Make we grow our own food. Dis no be di time to stop wen we see prices dey go up.

“Make we buy wetin we dey produce for di kontri,” Buhari tok.

Im add for im Eid message say “make we help one anoda to be our brothers keepers”.

Source