Meet Nigerians wey win election for di UK general elections

Di Labour Party win landslide victory for UK general election wey happun on 4 July 2024.

Di party sweep hundreds of seats across di kontri and end 14 years of Conservative rule.

Some candidates wey be of Nigerian-descent bin contest for seats for di parliament and win.

Out of 30 of dem, six bin gbab seats to represent dia different constituencies.

Di Labour party wey win di majority seat for di parliament get di highest number.

Eight British Nigerians bin represent di party for dia constituencies and na four of dem win dia seats.

Di Conservative bin get four Nigerians wit two of dem dey re-elected.

Tins to know about di Nigerian decent MPs

Bayo Alaba

Dem born and raise Bayo Alaba for Forest Gate, East London.

Alaba na of Board Trustee for Phoenix Resource Centre, one ogbonge charity wey dey operations for di UK and abroad.

MP Bayo Alaba bin win Newcastle under Labour Party

Di British businessman wey be of Nigerian decent, win di Southend East and Rochford for Labour Party.

Alaba gbab 15,395 votes against di Conservative Party candidate, Gavin Haran wit 11,368 votes.

E be Labour Councillor, former Parachute Regiment soldier, school governor, youth mentor, charity trustee and one of the pioneers of east London creative economy.

He be husband and papa of three pikins dem.

Alaba get over two decades of experience for community, voluntary service.

During im campaign e bin send one ogbonge message to Westminster say– “you no fit hold Southend back any longer!”

Alaba dey currently serving as di first black councillor for di London Borough of Redbridge.

Kemi Badenoch

Dem born Ms Badenoch, for 2 January 1980 for Wimbledon, London.

She be one of three pikins of Nigerian Yoruba parents, Femi and Feyi Adegoke

Di British-Nigerian politician, Kemi Badenoch bin retain her seat for North West Essex for one tight race.

Di Conservative Party no too win for dis general election.

She be di Secretary of State for Business and Trade for Rishi Sunak cabinet.

Badenoch gbab 19,360 votes – 35.6 per cent of di total votes, wey be di decrease of 26.1 per cent from her previous majority.

Kemi Badenoch bin don serve as di MP for Saffron Walden since 2017.

Her papa, Femi Adegoke, na GP and her mama Feyi Adegoke, na professor of physiology.

Ms Badenoch bin spend her childhood for Lagos, Nigeria and di United States, wia her mama bin dey lecture.

She bin return to di UK for age 16 to live wit her mama friend.

Despite say dem born her for di UK, Badenoch, during her parliamentary maiden tok say she be “to all intents and purposes first-generation immigrant.”

Taiwo Owatemi

Dem born Taiwo Owatemi for 22 July, 1992, she bin grow up for Plumstead.

Her mama wey be nurse bin raise her and her two brodas afta her papa die wen she be six years old.

Ms Owatemi bin first dey elected into the UK Parliament in 2019.

A former Member of Parliament of Nigerian descent, Taiwo Owatemi, also won the UK Parliament election in Coventry North West for the Labour Party.

Taiwo Owatemi hold Master degree for Pharmacy from di University of Kent.

She be qualified pharmacist and bin practice for NHS Trust bifor she enta politics.

For December 2023, She bin announce say she don her first pikin-daughter.

Owatemi gbab 19,696 votes to beat her main rival, Tom Mercer of di Tories, wey gbab 8,522 votes.

She bin serve as di Shadow Minister for Women and Equalities from September 2021 to September 2022.

Owatemi na member of Labour Friends of Israel and part of di delegation wey bin travel to di kontri for February 2023.

Chi Onwurah

Dem born Chinyelu Susan “Chi” Onwurah for 12 April 1965 for Wallsend.

She bin go Kenton School, Newcastle and gbab degree for Electrical Engineering from Imperial College London.

Di British politician of Nigerian decent who na member of Labour Party wey first hold office for 2010.

Chi Onwurah now dey re-elected as MP to represent Newcastle on Tyne Central and West for di Labour Party for di UK Parliament election.

Onwurah gbab 18,875 votes on 4 July as di Labour Party win wella for dis election to comot di Tories.

Bifor di election, she be Shadow Minister for Industrial Strategy.

Florence Dauta Eshalomi

Dem born Florence for 18 September 1980.

Di British politician of Nigerian decent bin serve as Member of Parliament (MP) for Vauxhall from 2019 until dem cancel di seat for 2024.

Eshalomi nee Nosgbe na member of di Labour and Co-operative parties.

She be Member of di London Assembly (AM) for Lambeth and Southwark from 2016 to 2021.

She win election as di MP for di Vauxhall and Camberwell Green constituency wey dem just create for 2024 general election.

She be di first member of her family to go to university.

Eshalomi bin graduate wit BA Hons for Political & International Studies wit Law from Middlesex University.

She gbab total of 21,528 votes for dis 2024 elections.

Source