Who dey run Lebanon and which power Hezbollah get?

Hezbollah members dey troway salute for di burial of dia members wey die for April 2024

Getty Images

Lebanon dey under serious missile attacks from Israel for di past two weeks, wey don kill ova 1,000 pipo. Israeli troops don also enta dia territory.

Dis na becos of di current katakata wey dey happun between Israel and Hezbollah – one political party and militia wey dey base for di kontri.

Hezbollah militia dey more powerful dan Lebanon national army and e get popular support, especially amongst di Shia Muslims for di kontri.

Dem no be official organisation for di kontri, but dem don becom a powerful force wey dey lead within Lebanon ova di past four decades.

Who dey govern Lebanon?

For Lebanon, political power dey divided between di various religious sects wey dey inside.

According to one convention wey dem bin agree on for 1943, wen Lebanon gain independence from France, di president bin need to be a Christian from di Maronite sect, di prime minister go be Sunni Muslim and di speaker of parliament go be Shia Muslim.

Dis reflect di relative sizes of di different religious groups for Lebanon dat time. Dat time, Christians bin plenti pass, and na dem make up over half of di population, dem plenti pass di Sunni and Shia Muslims.

However, many pipo tok say d i agreement for dat don old and e dey outdated since Christians, Sunni Muslims and Shia Muslims according to estimate now make up just over 30% of di population each.

By convention, Christians and Muslims also get equal amount of seats for parliament, even though Muslims in total now make up di majority of di population.

In practice, no one party or religious sect fit hold overall power for Lebanon. Dem dey make up goments wit collabo for parliamentary coalitions, and dem need to take all big decisions by consensus. Dis dey cause political paralysis evritime.

Wetin be Hezbollah status for Lebanon?

Foto of one school for southern Beirut wey Hezbollah sponsor.

Getty Images
Hezbollah dey provide schools, hospitals and social services for di Shia parts of Lebanon.

Dem bin setup Hezbollah as a Shia Muslim militia for 1982, during di Lebanese civil war, to block di Israeli forces wey bin dey occupy southern Lebanon dat year.

Dem dey extensively armed and na di Islamic Republic of Iran dey fund dem. Hezbollah na Arabic for “di party of God”.

Hezbollah officially announce dia existence for 1985, wia dem declare say dem want to establish one Islamic state for Lebanon, like di one for Iran.

Dem also vow to end di way wey Israel dey occupy southern Lebanon and di Palestinian territories.

For 2009, dem bin bring out one new manifesto wey no make any made no reference say dem wan create an Islamic state. However, dem maintain dia stance against Israel.

Wen Lebanon civil war end for 1990, dem bin disband all di factions and dia militias but only Hezbollah remain.

Hezbollah bin say dem need to Israel occupation in for di south.

Israel finally withdraw dia forces from di area for 2000, and Hezbollah bin claim say dem don win Israel.

Hezbollah supporters at a political rally in eastern Lebanon in 2022

Getty Images
Hezbollah dey get extensive political support from di Shia population for Lebanon.

For 1992, Hezbollah start to dey bring candidates for parliament.

Now dem get plenti Members of Parliament (MPs), and Hezbollah ministers dey for goment too.

Dem dey alos provide tins like schools, healthcare and social services for areas of Lebanon wey get large Shia communities.

Oda parties for Lebanon also provide di same services for dia constituents, but pipo beliv say Hezbollah get di widest network of all.

How Hezbollah take grow to get plenti power for Lebanon?

Foto of Hezbollah militia fighters for southern Lebanon, near di border wit Israel

Getty Images
Pipo beliv say Hezbollah militia na one of di strongest non-state armies for di world

Hezbollah get much of dia power for Lebanon sake of dia militia. Dem tok say dia militia get 100,000 fighters, but independent estimates say dia number dey between 20,000 and 50,000.

Hezbollah also get arsenal ( different type of weapons) of between 120,000 and 200,000 rockets and missiles, according to di US-based tink tank, di Center for Strategic and International Studies.

Tori be say dem be one of di most powerful non-state armies for di world. Dem consider dem as group wey strong pass di National army for Lebanon.

Dem don also benefit from di weakness of Lebanon national goment. For example, di kontri no get president since 2022 sake of say di political parties no wan agree on who go be President.

Di central goment no too strong to prevent Hezbollah from pursuing dia own agenda.

Source