Germany v Japan: Ilkay Gundogan goal don put di Germans ahead

Germany dey celebrate

Getty Images

Germany and Japan wey dey for Group E dey meet today for di 2022 World Cup wey dey shele for Qatar.

Na four times Germany don win di World Cup (as both Germany and West Germany).

Dem don also be runners-up four times. Germany don also win di European Championship three times and dem don also be runners-up three times.

Dem head to Qatar to prove a point afta dem finish bottom of dia group for Russia four years ago – dat na dia earliest World Cup exit in more dan 80 years – before dem lose to England in di last-16 for Euro 2020.

Di 2022 World Cup na Japan seventh consecutive World Cup appearance and dem don reach di last-16 three times, including wen dem co-host di tournament for 2002.

How di game dey happun live

FIRST HALF

45+5 mins

Half-time

Germany 1-0 Japan

Referee blow di half-time whistle.

Japan bin start well but lack of concentration from Shuichi Gonda give Germany one penalty, wey improve dia playing.

45+4 mins: No be goal! Na offside. Anoda escape for Japan

No goal. Another escape for Japan.

45+4 mins: Video Assistant Referee. VAR dey go check am out.

45+4 mins: Kai Havertz put di ball inside di net – but shey na offside?

45+2 mins: Japan look desperate for di half-time whistle. Dem no fit escape from di edge of dia own penalty area at di moment.

45 mins: Great skill from Jamal Musiala as im skip away from two challenges on di edge of di box, but im shot dey always rise and e go ova di bar.

Dem go add four minutes at di end of dis half, wey dey conservative compared to wetin we don see so far for dis tournament.

42 mins: Germany dey look dangerous now. Anoda flowing move see Thomas Muller tee up Joshua Kimmich, but im effort go ova di bar.

37 mins: Four players dey forward for anoda rapid counter-attack, but Takefusa Kubo cross from di right dey poor.

Im get three players in blue to aim for dia. Di final pass dey let Japan down at di moment.

33 mins: GOAL!

Germany 1-0 Japan

Ilkay Gundogan SCORE.

Ilkay Gundogan send Shuichi Gonda di wrong way to give Germany di lead!

31 mins: PENALTY TO GERMANY!

Shuichi Gonda make David Raum fall and di referee point to di spot!

29 mins: One decent move from Germany find Ilkay Gundogan for space 25 yards from goal, but Shuichi Gonda easily save di player first-time shot.

Daizen Maeda of Japan score dia first team first goal wey dem later rule as offside

Getty Images
Daizen Maeda of Japan score dia first team first goal wey dem later rule as offside

22 mins: Joshua Kimmich shoot ball from distance wey Shuichi Gonda punch away diving to im right. Di offside flag kon deny di Germans as dem look to seize on di rebound.

17 mins: First chance for Germany.

Antonio Rudiger rise for di far post to meet one corner, but im header go wide off di post.

Goalkeeper Shuichi Gonda go even catch am sef.

12 mins: Jamal Musiala look to get in behind di Japan defence down di left, but Wataru Endo tackle am and clear am out for a throw.

8 mins: Dem cancel goal.

Daizen Maeda shoot di ball inside di net but dem rule am out as offside. Na rapid counter-attack by Japan afta dem win di ball for di midfield. Junya Ito den put one dangerous ball across for Maeda to tap home, but e no dey successful.

2 mins: Na bright start by Germany as Serge Gnabry attempt to wave im way through di entire Japanese defence, but e no dey successful.

1 min: Di referee Ivan Barton blow whistle and match start. Germany na dem kick-off.

KICK OFF!

Germany 0-0 Japan

Germany v Japan

Getty Images

Germany line-up

1 Neuer

15 Süle

2 Rüdiger

23 Schlotterbeck

3 Raum

6 Kimmich

21 Gündogan

10 Gnabry

13 Müller

14 Musiala

7 Havertz

Substitutes

4 Ginter

5 Kehrer

8 Goretzka

9 Füllkrug

11 Götze

12 Trapp

16 Klostermann

17 Brandt

18 Hofmann

19 Sané

20 Günter

22 ter Stegen

24 Adeyemi

25 Bella-Kotchap

26 Moukoko

Japan line-up

Germany v Japan

Getty Images
Daichi Kamada (2nd R) and Japan players warm up before dia FIFA World Cup Qatar 2022 Group E match between Germany and Japan for Khalifa International Stadium

12 Gonda

19 H Sakai

4 Itakura

22 Yoshida

5 Nagatomo

17 Tanaka

6 Endo

14 Ito

15 Kamada

11 Kubo

25 Maeda

Substitutes

1 Kawashima

2 Yamane

3 Taniguchi

7 Shibasaki

8 Doan

9 Mitoma

10 Minamino

13 Morita

16 Tomiyasu

18 Asano

20 Machino

21 Ueda

23 Schmidt

24 Soma

26 Ito