Life and Times of Brooklyn Nine-Nine Captain Raymond Holt wey die at 61

Andre Braugher attend NBC Comedy Starts Here for NeueHouse Hollywood on September 16, 2019 for Los Angeles

Getty Images

Andre Braugher, di star of Brooklyn Nine-Nine and Homicide: Life on di Street don die at di age of 61 afta one brief illness.

Braugher often dey play di role of police officer during im career, e also dey perform both dramatic and comedic roles.

E win two Emmy Awards, from a total 11 nominations across im career, for im roles for Homicide and Thief.

Terry Crews, wey play di role of Terry Jeffords for Brooklyn Nine-Nine, don pay tribute to Braugher “irreplaceable talent”.

“I dey honoured to have known you, laugh wit you, work wit you and share eight glorious years watching your irreplaceable talent,” Crews post on Instagram.

“Dis one hurt. You leave us too soon. You bin teach me so much. I go forever dey grateful for di experience of knowing you. Thank you for your wisdom, your advice, your kindness and your friendship.

“You show me wetin a life well lived look like.”

Who be Andre Braugher?

Andre Braugher pose afta e win Emmy

Reuters
Braugher win Emmy for 2006 for outstanding lead actor for inside one miniseries or movie for im work on Thief

Dem born Braugher for Chicago. E graduate from Stanford University before attending di Juilliard School for drama.

E dey nominated for 11 Emmy Awards – including four for im role as Captain Raymond Holt for Brooklyn Nine-Nine.

E win for 1998 for im role for Homicide: Life on di Street, and in 2006 for im performance for Thief, wia e play di role of di leader of one heist crew.

Braugher breakthrough happun for 1989 film Glory, wia e play di role of soja for one black Union regiment for di American civil war.

Na Ed Zwick direct di feem wey also feature Matthew Broderick, Morgan Freeman and Denzel Washington – wey win im first Academy Award for im supporting role for di feem.

Braugher television career flourish afta playing detective Frank Pembleton for di Baltimore police show Homicide: Life on di Street, di movie wey e take win Emmy Award for 1998.

E recently feature for She Said, di biographical drama wey show Carey Mulligan and Zoe Kazan play di role of investigative journalists wey break di Harvey Weinstein story. E play di role of Dean Baquet, di New York Times executive editor wey oversee di two reporters.

Di actor oda feem credits include Primal Fear, wey e do alongside Richard Gere, Salt, wit Angelina Jolie, and City of Angels, Meg Ryan and Nicolas Cage.

But many pipo go remember am best for im role as Captain Ray Holt for Brooklyn Nine-Nine, wey see Braugher star alongside Andy Samberg, Stephanie Beatriz, Joe Lo Truglio and Melissa Fumero.

Tributes pour in for Andre Braugher

Andre Braugher

Getty Images
Braugher go dey best remembered for im role as Ray Holt for di sitcom Brooklyn Nine-Nine

David Simon, wey im non-fiction book Homicide: A Year on di Killing Streets inspire di show Homicide: Life on di Street, tok say Braugher death dey “too damn soon”.

“I don work wit plenty wonderful actors. I no go ever work wit one wey dey beta,” Simon, wey also create The Wire, tok on Twitter.

Actor Marc Evan Jackson, wey play Braugher on-screen husband for Brooklyn Nine-Nine, share one foto wey show as di two of dem dey hug for set, wearing dia wedding rings.

E caption di post on X: “O Captain. My Captain.”

Joe Lo Truglio, wey play Detective Charles Boyle on Brooklyn Nine-Nine, post on Instagram about being on set wit Braugher.

E write: “Wetin you fit no sabi about Andre na say e fit sing too, and dey sing most times at lunch. At first, e dey odd but den very quickly, e make sense for di world because di man dey so full of song and dat na why di world notice.”

Chelsea Peretti wey feature alongside Truglio as Gina Linetti for di show, tok say she go “forever dey lucky to don go on such a journey” wit Braugher.

Ryan Case, wey direct di US sitcom, post one thread of her favourite memories of Braugher on X, she write say: “My ‘challenge’ editing him for di Brooklyn pilot na finding takes wia e no dey smile. We wan save dat for di end. E be like giddy school child wey dey do im comedy and e dey so wonderful.”

Dirk Blocker, another co-star, wey dey popular for im role as Michael Hitchcock, say: “Fiercely intelligent, remarkably kind, supportive, generous and e possess a deep and extraordinary talent, and e get even more to offer. I dey devastated. I love am.”

Speaking to BBC News earlier dis year, Homicide writer and producer Tom Fontana praise Braugher screen presence, charisma and energy.

“I neva see actor like dat on television,” Fontana tok. “Im rhythms dey so unique.”

Braugher oda notable credits include Benjamin O Davis for Tuskegee Airmen, Dr Ben Gideon for Gideon Crossing – wey win am Golden Globe nomination – and Owen for Men Of A Certain Age, all roles wey make win Emmy Award nominations.

Mike Royce, wey co-create Men Of A Certain Age, e tok on Twitter say: “Dis dey impossible for me to process. E be di best actor for di world. Na incredible human being e be. An incomprehensible loss.”

Braugher die on Monday afta one brief illness, im publicist Jennifer Allen tell PA news agency.

E dey survived by im wife, actress Ami Brabson, wey meet am on di set of Homicide, and im three sons.

Source