Justin Bieber and wife Hailey dey expect dia first child

Justin Bieber and im wife Hailey

Getty Images
Justin nd Hailey Bieber don dey married since 2018

Ogbonge Canadian singer Justin Bieber and im Super Model wife Hailey don announce say dem dey expect dia first child togeda.

Justin Bieber share one video for im Instagram page on May 9 wey show im wife Hailey Bieber dey hold her baby bump.

But Justin Bieber no tok anything more to explain di video.

Famous faces including US reality star Kim Kardashian and model Gigi Hadid post dia congratulations under di announcement for Instagram.

Although im no tok anything, pipo don flood dia social media pages to congratulate di couple.

One representative for Hailey confam to The Associated Press on Thursday say di model dey just over six months pregnant.

Inside one press release, fashion house Yves Saint Laurent say di video and photoshoot na from di Biebers dia vow renewal ceremony on Thursday for Hawaii.

Hailey na di daughter of actor Stephen Baldwin, while Justin bin dey discovered as a singer at di age of 13 and e go on to become pop sensation with hits including Baby, Love Me and Yummy.

In addition to modelling, Hailey na di founder of one skincare line, Rhode.

Last year, Justin bin dey forced to cancel di remaining dates of im Justice world tour as e dey recover from Ramsay Hunt syndrome, one condition wey fit cause facial paralysis.

Di Canadian singer unexpectedly step on stage for Coachella last month to perform di 2020 hit single Essence, alongside Wizkid, during one set by Nigerian star Tems.

Justin and Hailey Bieber

Getty Images

Hailey and Justin, 30, bin marry for one secret ceremony for New York for 2018.

She and Justin, wey be 24 at di time, bin announce dia engagement for July dat year. Justin write for Instagram say: “Hailey I dey soooo in love with everything about you!

“So committed to spending my life getting to know every single part of you loving you patiently and kindly.

“My heart dey COMPLETELY and FULLY YOURS and I go ALWAYS put you first!

“You be di love of my life Hailey Baldwin and I no go wan spend am with anybody else.”

Source