Baba Suwe son Omidina Adebowale say im papa no recover from NDLEA drug accuse palava

One of di late Nigerian actor, Babatunde Omidina, AKA Baba Suwe son, Omidina Adebowale Jr don narrate wetin hapun during di last moments of im papa life.

Adebowale bin dey with im papa Baba Suwe wen im die on Monday, 22, November, 2021.

According to am, im papa no recover from di NDLEA gbege wey lead to im arrest ontop accuse say e carry cocaine for 2011.Adebowale tell tori pipo on Tuesday say im papa recover from di effect of dat ordeal. Baba Suwe die at di age of 63 afta e bin dey sick.

Earlier on, Baba Suwe son Sola Omidina bin confam Baba Suwe death to BBC Pidgin on Monday, say di Nigerian comedian die around afternoon dat day.

But Adebowale wey dey with am wen im die don tok how e hapun.

Baba Suwe last moments

Baba Suwe son Omidina Adebowale Jr wey bin dey with im papa wen e die say im papa na very strong man. E say hm be go gym wen im mama call am say im papa no dey breathe well.

“Wen I reach house, I enta im room to tok to am and e try to respond but e no fit. My papa na very strong man. E no wan leave us but death dey more powerful. E bin dey on first drip wen I reach house, so dem give am second drip before I komot from im room to wash my kits.

“Wen I dey wash my kits, my mama take me to my room and say my papa don die. Shock hold me for body and na why I post di video on my WhatsApp status. Di video bin go viral witihn five minutes wey I post am,” Junior tok.

Baba Suwe foto

BBC

Who be Baba Suwe?

Dem born Babatunde Omidina aka Baba Suwe on August 22, 1958, for Inabere Street for Lagos Island.

But di legendary actor come from Ikorodu local goment area of Lagos.

E marry e wife, Omoladun Omidina wey also be actor for 1995 and she die for September, 2009.

Di popular actor bin attend Jamaitul Islamial Primary School for Lagos, and Children Boarding School, Osogbo.

After im boarding school, Baba Suwe bin get im West African School Certificate for Ifeoluwa Grammar School for Osogbo, Osun State, southwest Nigeria.

Baba Suwe begin acting career for 1971 and e bin act for both English and Yoruba language films.

Di veteran Nollywood comedian dey often play di role of confuse servant or security guard.

E become popular afta e feature in one movie titled, Omolasan.

Im become more popular afta e act for Iru Esin wey Olaiya Igwe produce for 1997.

Pipo gada for Baba Suwe house afta im death

BBC
Pipo gada for Baba Suwe house afta im death

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin arrest Baba Suwe afta dem accuse am of trafficking cocaine for 2011.

As di agency put am for custody sake of say dem want make e excrete di cocaine wey dem suspect say e dey im stomach, nothing come out of Baba Suwe belle.

Di agency chop blame ontop di case and court come judge say make dem pay Baba Suwe more than $155,000 as compensation and apologise to am.