Which Premier League clubs dey go Europe?

Premier League champions 2024

Getty Images

Manchester City, Arsenal, Liverpool and Aston Villa don already qualify for di Champions League.

Tottenham Hotspur don also get guarantee spot for do Europa League.

If Manchester City win di FA Cup final, den Chelsea go play for di Europa League and Newcastle go see dia sef for di Conference League.

But if Manchester United win di FA Cup, den di Red Devils go be di second Premier League club to go Europa League.

Chelsea go end for di Conference League and Newcastle go miss out of European competition completely.

Manchester United end dia worst Premier League season

Rasmus Hojlund and Diogo Dalot help Manchester United finish dia worst Premier League season wit a 2-0 victory for Brighton.

Despite di win, Erik ten Hag side end di campaign in eight position – dia lowest top-flight finish since 1989-90.

Brighton, meanwhile, fail to give dia coach wey dey comot, Roberto de Zerbi di perfect send-off, despite say dem get better chances and dominate possession.

Adam Webster and Joao Pedro come closest to score for di Seagulls ahead in di first half, but dem lack di clinical advantage to beat Andre Onana.

Brighton go regret dia missed chances wen Dalot beat Jason Steele in di 73rd minute, bifor substitute Hojlund seal di three points two minutes bifor di end of normal time.

Di Seagulls end di season 11th, missing out on di top half by one single point.

Bifor dia season-finale against Brighton, Ten Hag say Manchester United dey in a stronger position now dan dem bin dey 12 months ago.

But dem don change position from dia third-place finish and di Champions League for eighth position, along wit di possibility of no European football next season.

Dia performance for Amex Stadium expose how dem flop dis season, as United struggle to deal wit Brighton hard passing and dem no see ball play for di most part of game.

However, centre-back Casemiro wey dem dey manage put forget all di tins wey don happun to am and keep United in di game wit a brilliant goalline clearance from Joao Pedro.

Despite dia worst Premier League finish, dem still get some positives dis season and Hojlund performance off di bench na example.

Source