Liverpool vs Real Madrid highlights: Vinicius Jr goal give Real Champions League win

Luka Modric (left)

Getty Images

Real Madrid na di Champions of Europe afta dem win di Champions League Final.

All eyes eyes bin dey on Stade de France, di venue of di 2022 Uefa Champions League final between Liverpool and Real Madrid.

Di match bin dey delayed by 30 minutes sake of issues wey concern fans.

Liverpool fans

Getty Images

Up to 60,000 Liverpool fans – many without tickets – bin dey expected for di French capital as Jurgen Klopp Reds bin attempt to win di FA Cup, Carabao Cup and Champions League treble for dia 63rd and final game of 2021-22.

But Real Madrid stand for dia way and cut dat dream short to become di 15-time winners and dia Italian boss Carlo Ancelotti win di competition for a fourth time – di highest by any manager for di tournament history – afta e lead AC Milan (2002-03, 2006-07) and Real (2013-14) to European glory.

See how di match happun LIVE here:

First Half

KICK-OFF

Liverpool 0-0 Real Madrid

I min: Game don start!

Di Champions league final dey underway.

1 min: Sadio Mane hustle to win di ball from Dani Carvajal and Liverpool get free-kick as Thiago dey fouled.

3 min: Trent Alexander-Arnold play di free-kick ontop di head of Karim Benzema, e clear am. Anoda follow-up ball afta dat one but Thibaut Courtois catch am.

4 mins: Hmm, close one for Real as Thibaut Courtois dey closed down by Jordan Hendeson but e boot am out to safety.

5 mins: Jordan Henderson play one long ball forward towards di box but Real keeper Thibaut Courtois run go di edge of im box to reach dia before Mohamed Salah.

7 mins: Call for free-kick for Liverpool as Casemiro tackle Sadio Mane. But Referee say no and Real break but dia cross dey cut out.

Sadio Mane look like say e dey in pain.

10 mins: 10 minutes of ball but nothing for both side yet.

11 mins: Sadio Mane run catch di ball down i right and hook am across di box. E roll to Mohamed Salah, but e shoot am over. But di officials notice say di ball bin don go out of play before Mane cross so e for no count.

14 mins: Luis Diaz control one long ball down di left and cut enta di box but no shooting come out of am.

Andy Robertson hook am cross enta di box but Ferland Mendy play am off give im keeper.

15 mins: Ibrahima Konate show great defending to get di ball from Vinicius Jr on di right and den go forward.

17 mins: Thibaut Courtois deny Mohamed Salah di opener wit im save. Trent Alexander-Arnold put in a cross to Salah, who poke am towards di bottom corner but Courtois save am.

18 mins: Liverpool again oh! Sadio Mane find Mohamed Salah for di box and e play am straight to Thibaut Courtois.

Three saves and counting for Real keeper.

20 mins: Another lovely passing move by Liverpool as Jordan Henderson lift di ball over di top to Sadio Mane for di box.

Liverpool hold di ball and eventually Trent Alexander-Arnold decide to shoot for di box but im side-foot am over di bar.

21 mins: Almost! Sadio Mane hammer in one shot for di box. Courtois stretch to im full length to tip it am on di goal post. Di ball roll out but Real stop am.

24 mins: David Alaba keep out Mohamed Salah through ball to Sadio Mane.

25 mins: Two Liverpool players team up to try to stop Vinicius Jr but e still play di go di box – Alisson catch am.

27 mins: Dani Carvajal play one-two from a throw-in and den send di ball across di pitch to one Liverpool player. E dey too far away from goal for di Reds to take advantage.

29 mins: Liverpool midfielder Fabinho shoot di ball high and wide from a distance.

31 mins: Trent Alexander-Arnold do good defending to stop a ball over di top from reaching Vinicius Jr.

Mohamed Salah break for Liverpool but Toni Kroos stop am for di box.

33 mins: Virgil van Dijk track Vinicius Jr’s run and stop Karim Benzema from finding am with a clever through ball afta dem get di opportunity down di left wing.

Picture of Courtouis dey save ball

Getty Images

35 mins: Liverpool again!

Trent Alexander-Arnold find Mohamed Salah for di box but im header am straight give Thibaut Courtois.

Sadio Mane come put Courtois for work as he try to clear.

36 mins: Liverpool captain Jordan Henderson drop back into im box to tackle Vinicius Jr, wey no allow Ibrahima Konate.

Real get dia first corner but Liverpool clear and Luis Diaz dey fouled by Dani Carvajal to stop a counter.

39 mins: Luis Diaz run down di left for Liverpool, but Dani Carvajal tackle am.

Diaz run afta Thibaut Courtois, but e clear am in time.

40 mins: Liverpool corner as Eder Militao slide in to stop Sadio Mane from Andy Robertson’ ball.

41 mins: Andy Robertson corner dey cleared to Jordan Henderson, wey play am towards goal from 35 yards but e fly wide.

GOAL DISALLOWED

Karim Benzema run onto a ball over di top and take too many touches before e lose di ball. Ibrahima Konate and Alisson run into each oda and e be like di ball hit Fabinho before Benzema play am home.

Di offside flag go up.

VAR Check

VAR dey check. Who get di last touch before Karim Benzema score? If na Fabinho e be like na goal. If e hit a Real player last, no be goal. But e look very close.

Di goal dey ruled out for a Karim Benzema offside.

45+3 mins: Injury time now. Di VAR check bin take long.

HALF-TIME

Liverpool 0-0 Real Madrid

Na half-time.

Liverpool dominate for about 40 minutes, Sadio Mane ball hit post, but Real Karim Benzema goal dey disallowed for offside just at di end of first half.

Kareem Benzema

Getty Images

Second Half

KICK-OFF

Liverpool 0-0 Real Madrid

46 mins: Second half don start.

47 mins: Correct defending by Dani Carvajal. Trent Alexander-Arnold pick out a wonderful cross to Luis Diaz, e bin wan head am but Carvajal head am first.

49 mins: Ferland Mendy block Mohamed Salah as e run onto di ball for di box. Real try to break and Trent Alexander-Arnold foul Casemiro.

53 mins: Luis Diaz win di ball for im left-back position, e send am to im team-mate.

54 mins: Luis Diaz run down di left and find Sadio Mane, im shot dey blocked. Trent Alexander-Arnold get chance but e also dey blocked.

55 mins: Real keeper Thibaut Courtois palm out Trent Alexander-Arnold cross into Thiago.

56 mins: Real defender Eder Militao go down wit im hand over im face.

58 mins: Liverpool dey shout for penalty.

Trent Alexander-Arnold find Mohamed Salah for di box. E shoot, e hit defender, e shoot again, e hit defender.

Di second one hit David Alaba arm but e dey down by im side so no handball.

Vinicius Jr celebrate goal

Getty Images

GOAL – Liverpool 0-1 Real Madrid

Vinicius Jr

Federico Valverde get di ball on di right, run forward and den blast a low ball across di box.

Vinicius Jr ghost in behind Trent Alexander-Arnold and slot into di empty net from close range.

Real Madrid dey lead di Champions League final.

62 mins: Liverpool midfielder Fabinho dey booked for catching Federico Valverde with a late tackle.

Mo Salah for di game

Getty Images

65 mins: Mohamed Salah come in from the right wing and curl one shot towards di far corner but e dey saved by Thibaut Courtois.

SUBSTITUTION

65 mins: Liverpool 0-1 Real Madrid

Liverpool make dia first change as Diogo Jota replace Luis Diaz up front.

66 mins: Andy Robertson free-kick dey headed away. Liverpool come back but Eder Militao head away Sadio Mane cross.

68 mins: Eder Militao throw imself down trying to get a free-kick butdi referee give di corner to Liverpool.

Dani Carvajal head am away

69 mins: Liverpool get anoda corner wey David Alaba play away.

70 mins: Thibaut Courtois again stretch imself across di goal to keep out Mohamed Salah effort out.

72 mins: Vinicius Jr run down di left, and just as e bin wan reach di box, Konate slide in to stop am.

75 mins: Trent Alexander-Arnold, fire in shot wide from 25 yards.

78 mins: SUBSTITUTION

Double change for Liverpool. Roberto Firmino and Naby Keita replace Thiago and Jordan Henderson.

79 mins: Trent Alexander-Arnold get di ball on di right side of di box and fire in one low pass across di box but e cut out.

80 mins: Real Madrid defender Eder Militao take im time for ground and di referee tell am to get up.

83 mins: Thibaut Courtois. Dis keeper!

Mohamed Salah control di ball on di edge of di area, beat one defender well and fire in shot wey Courtois tip around di post.

84 mins: Real no take good advantage of one counter-attack wey for give dem more leg for di game.

86 mins: SUBSTITUTION

Real Madrid make dia first change as Eduardo Camavinga replace Federico Valverde.

87 mins: Vinicius Jr get di ball on di wing and cut enta inside. E give am to Karim Benzema, but Trent Alexander-Arnold tackle am.

Liverpool counter but Casemiro defend well.

88 mins: Thibaut Courtois catch one corner well, go ground and hold im face.

INJURY TIME

90 mins: Liverpool 0-1 Real Madrid

FIVE minutes for Liverpool to do sometin.

90+1 mins: Dani Ceballos get in behind everyone but e no get di pace and lose di ball. Dem win a corner though.