Mr Ibu dey make im final journey home today

Di family of late ogbonge actor, Mr Ibu wey im real name be John Okafor, dey bury am today June 28, 2024.

Di event dey happun for im hometown, Eziokwe Amuri, Nkanu West Local Government Area of Enugu State.

“Di Okafor family for Eziokwe Amuri, Nkanu West LGA for Enugu State wish to honour di loving memory of our hero and legend, wey even for death don leave one legacy of love, laughter and liveliness,” Sunday Okafor wey be di late actor broda tok for statement.

Mr Ibu die on 2 March 2024 afta im battle one “strange and dangerous illness” as e bin describe am dat time.

Mr Ibu battle wit illness

For one video wey im share on top social media for October 2023, di late actor bin beg im fans to pray for am.

E bin tok say im dey hospital for sometime sake of one “strange and dangerous illness”.

E say doctors don recommend make dem cut im legs.

“As I dey speak to you, I still dey lie down for hospital; di medical director of dis hospital say di best solution be say, in case im new idea no work, di best idea na to cut off my leg”, e tok for di sick bed,

Mr Ibu further tok say make im fans tok to God as im no wan make dem cut im legs.

Mr Ibu adopted daughter also bin enta social media beg for support for her papa.

Jasmine Okafor, bin beg make individuals or organizations help her papa for treatment abroad.

“For di past two weeks, daddy don dey very down, so we take am to hospital.

We bin don dey do everytin humanly possible; as family, we bin tink say na sometin we fit do on our own for am to dey fine, but e no dey get any better.

E no dey get better. Some days, e go be like say e don dey get better, some days, e go be like say e dey get worse,” Jasmine bin tok.

“We dey for one of di best private medical facilities for Lagos, and dem wan refer us to anoda hospital sake of say e no get better here, she add.

Dat October post about im sickness no be di first time wey di late actor sickness go enta public space be dis, for March 2022, Mr Ibu bin announce say e dey down wit food poisoning.

One month afta di October post, dem amputate Mr Ibu leg afta e undergo seven surgeries.

Many Nigerians bin donate money to support di late actor treatment afta im families bin ask for financial help for social media to fit pay Oga Ibu medical bills.

E later die for 2 March, 2024.

Tins to know about late Mr Ibu

Born as John Ikechukwu Okafor for October 1961, Mr Ibu na actor, stand-up comedian and MC from Enugu state, Southeast Nigeria.

E don act hundreds of Nollywood movies both for Nigeria and abroad including Mr. Ibu series.

Mr Ibu bin spend im early life for Sapele wia e bin work to send imself to school and support im family.

Di late actor be football coach, Karate practitioner and boxer bifor e enta acting

Pipo sabi am for how im dey take keep im face wen e wan make pesin laff.

Im dey also dance and crack jokes.

Mr Ibu bin marry two times for im life and e get children from both marriages.

Fotos from di burial

Crowd gather dey watch vehicles wey dey pass during di burial of late Mr Ibu

BBC
Crowd gather dey watch vehicles wey dey pass during di burial of late Mr Ibu

BBC
Crowd gather dey watch vehicles wey dey pass during di burial of late Mr Ibu

BBC
Crowd gather dey watch vehicles wey dey pass during di burial of late Mr Ibu

BBC

Source