Latest on new minimum wage as Nigerians still dey wait for labour unions and FG agreement

Di issue of di national minimum wage wey don dey go on for months still neva dey concluded as labour unions and federal goment neva come to agreement.

Na 62,000 naira tripartite committee on di new minimum wage bin propose as new minimum wage while organised labour insist on 250,000 naira.

Di latest na di Nigeria Labour Congress and di Trade Union Congress rejection of di proposal by di Southern Governors’ Forum to decentralise minimum wage negotiations to state goments.

According to di organised labour, di proposal na threat to workers and di economy.

NLC yarn for one statement on Friday 28 June by dia Head of Information and Public Affairs Benson Upah say to allow states to determine dia minimum wages “threaten di welfare of Nigerian workers and di national economy“.

“Dis notion no only dey dictatorial but also undermine di veri essence as well as di model adopted for creating a national minimum wage for Nigeria,” di statement tok.

Southern Governor’s Forum wan pay wetin dem fit afford

For one meeting earlier dis week, di Southern Governors’ Forum say di minimum wage no suppose dey uniform.

Dem say states suppose pay wetin dem fit afford.

“Di Forum discuss di minimum wage issues wey labour bin demand and unanimously agree say di minimum wage gatz dey reflective of di cost of living and ability to pay, and each State gatz dey allowed to negotiate dia minimum wage,” di governors tok for one communique.

How goment propose 62,000 naira as labour insist 250,000 naira minimum wage

Labour unions for dia Democracy Day statement say dem no dey back down on dia 250,000 naira new minimum wage proposal.

“Our demand still remain 250,000 naira only and dem neva give us any compelling reasons to change dis position during the tripartite negotiation process.”

Both goment and labour dey propose different amount for di wage proposal.

Nigeria goment say dem and di Organised Private Sector don agree on 62,000 naira ($41, £32) minimum wage for Nigeria workers.

For inside one statement, di Tripartite Committee on Minimum wage wey don dey meet since to discuss about di new minimum wage mata make recommendations afta dia meeting.

According to di statement, goment say dem don critically torchlight di National Minimum Wage and dem use ” all necessary parameters”.

Dem add say dem also apply social, economic and political considerations, relevant International Labour Organisations, Conventions and international best practices bifor di committee agree on di 62,000 naira new minimum wage.

Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) dey demand for new minimum wage even bifor President Bola Tinubu enta office for 29 May, 2023.

Oda tins goment consider as dem propose 62,000 naira as new minimum wage

According to di statement wey di Tripartite Committee release, dem tok say true true time don reach for an “upward review of di present National Minimum Wage” wey be 30,000 naira now since 2019.

Dem also agree say di advantages of di upward review of di National Minimum Wage plenty pass di disadvantages.

“Therefore, di Committee dey kindly invite presido to note say di Committee adopt di motion as di proposal of 62,000 naira per month as di new National Minimum Wage afta dem consider all oda factors”.

Dem also tell President Bola Tinubu to “note say di organised labour dey insist on 250,000 naira per month”.

“Finally di Committee hereby present 62,000 naira per month as agreed by goment and Organised Private Sector (OPS) wit policy incentives and oda conditions wey di States and di Organised Private Sector make.

Dem also present di 250,000 naira per month wey di organised labour dey recommend as di new National Minimum Wage make President Bola Tinubu look into am.

Source