Why Africans suppose care about UK general election

Richi Sunak and Sir Keir Starmer

Getty Images

On Thursday 4 July, UK go hold dia general election.

Di general election na to elect Members of Parliament – or MPs – go di House of Commons.

Millions of UK voters go enta polls to elect di 650 MPs wey go siddon for di House of Commons.

UK dey divided into 650 areas, dem call constituencies, each of these constituents go elect one MP to represent local residents.

Most candidates dey represent a political party, but some be independent candidates.

Political parties wey go contest for these elections don present dia manifestoes wey get policies wey go get impact on Africa and Africans.

Dis na some of di issues we think say go mata to you.

Migration

Di two major political parties for dis election, di Conservatives and di Labour Party don promise to reduce di number of pipo wey dey migrate enta UK if dem dey elected and also restrict illegal entry into di kontri.

Di Conservatives Party say immigration too high and dem wan attract only di brightest and best skilled migrants come di UK to contribute to dia businesses and public services.

Sake of dat, dem get to reduce di number of pipo wey dey migrate come di kontri to sustainable levels to reduce di impact di high numbers dey get on public services and housing, plus to also restore public confidence for di system.

Di way dem plan to achieve am na to put legal limit on migration. Dem say dem go make parliament fix number of work plus family visas and di numbers go dey reduce every year.

Meanwhile, Labour Party say dem go reform one points-based immigration system and end long-term reliance on overseas workers.

So, while Labour dey face accuse say dem dey avoid to commit to specific targets, Labour don also condemn di Conservatives say, dem miss targets in di past.

However, di Scottish National Party (SNP) no promise to reduce numbers of immigrants (as Labour and Conservative parties decide), but SNP want make Scotland get di power to attract more foreign migrants.

For inside di party manifesto, dem tok say if dem shift border controls go Holyrood, di SNP go reinstate free movement from di EU and dem go issue visas wit no much wahala.

For 2023, out of di 1.2million pipo wey go UK, 141,000 na Nigerians.

Di number pass dat of any oda African kontri and di second most non-European Union kontri afta India.

Education

Currently if you dey study for UK, dem go give you graduate visa wey allow you to stay for di kontri for at least two years afta graduation.

And only those wey dey on post-graduate research programmes fit bring dia family members come di kontri.

Di two major parties no mention say dem go change dat policy.

But Nigel Farage wey be di leader of Reform UK say im go ban students from bringing dia partners and children come UK.

Whereas di Green Party say dem go allow am and also give pipo wey get visa a right to vote.

Rwanda Scheme

Di current Conservative goment wan send some asylum seekers go Rwanda.

Currently, di deal dem get wit Rwanda na to deport 300 migrants wey illegally cross di English Channel enta UK go Rwanda.

For June alone, around 600 pipo bin land UK on small boats.

For dia manifesto, dem get plan to begin send these asylum seekers go Rwanda starting from July.

Opposition party Labour say dem go cancel di Rwanda scheme and instead hire new cross-border police officers .

Dem go also focus on cracking down on pipo wey dey smuggle gangs.

Whereas di Liberal Democrats say dem go like provide safe and legal routes for asylum seekers.

Plaid Cymru party also kick against di plan to send asylum seekers go Rwanda.

Dem say di party go like uphold UK observance of di international system, wey inside law guarantee di fair treatment of refugees.

Afta Brexit, e get one important element wey UK government fit pay attention to according to political analysts.

UK government now dey seriously try to build bilateral relationships wit African kontris.

Who be di best allies? Who be di best ambassadors to actually deliver dat message? Dr Anthony Francis Mveyange for African Population and Health Research Center believe say if UK goment fit leverage on students, dem go fit serve multiple purposes. One to serve African interest, at di same time, to serve UK government interests

So, winners of dis election dey intend to boost dia partnership wit di continent?

Di two main parties don tok about di importance of working wit di Commonwealth nations, wey of course include nations for Africa. And both Labour and di Conservatives bin don also tok about di importance of Britain role in providing development and for di continent.

Source