Wat next for Fubara as Appeal court reject order wey remove 25 pro-Wike members of Rivers assembly

Amaewhule, Fubara and Oko Jumbo

BBC
Di Court of Appeal Judgement dey critical to di determine how di political crises for Rivers Stage go be

Di Court of Appeal wey dey sidon for Abuja don nullify di removal of Martin Amaewhule and 24 odas as members of Rivers State House of Assembly.

Dis members na di ones wey dey loyal to di minister of FCT Nyesom Wike.

Di court say di ex parte order from di High court no make sense. Di appeal court say di lower court get right to give dat kain order.

Di Appeal court bin adjourn on 20 June 2024 after di parties for di suit adopt all dia briefs for di matter.

For di court proceeding wey dem conduct virtually, Amaewhule and di 24 odas dey ask di court to stay or stop di execution of a high court judgement wey push dem out of office and stop any further proceedings for dat case.

Dem also dey ask di court to set aside watever decisions Victor Oko Jumbo don take as e dey office as di Speaker.

For dia response, Victor Oko Jumbo dey pray to di court to dismiss di appeal say e no get basis becos di records of appeal wey dem transmit dey incompetent.

Afta e hear wetin lawyers of di two groups tok for di appeal, di three-man panel led by Justice Jimi Olukayode-Bada reserve judgment. Na on Thursday July 4 dem dey deliver di judgement.

Di appellate court for dia judgement dismiss di decision of di state high court wey stop dia members of di Assembly from accessing di complex or carry out any Legislative assignment in di name of di Rivers State House of Assembly.

To decide on whether di lower court get right to hear di mata, di appeal court say na only di Federal High Court get right to hear such matters and no be state high court.

Di three-man panel led by Justice Jimi Olukayode-Bada quote section 273 of di 1999 Constitution.

Di appeal panel diafore uphold di appeal wey Martin Amaewhule and 24 odas file against Victor Oko-Jumbo and two odas.

Di appeal court for one ruling on June 14 bin give order for all parties in di suit to maintain status quo, make nobody do any tin until di court hear and decide di mata.

Dis na to lay to rest a motion exparte wey dem bring bifor di court by di appellants (Martin Amaewhule) wey seek di reversal of a high court judgment wey declare dia seats vacant as lawmakers.

Di appeal court also stop di State High Court or any oda court from accepting di mata until e dey decided.

One Rivers State High Court for Port Harcourt on 10 May 2024, stop Martin Amaewhule from parading imsef as di Speaker of di Rivers State House of Assembly.

Di court give di order afta considering motion wey di new Speaker of di House, Victor Oko Jumbo, and two odas bring.

Justice Charles Wali, as e rule on di motion also bar 24 oda members of di Assembly from accessing di complex or carrying out any legislative assignment in di name of di Rivers State House of Assembly.

As dem no dey satisfied wit di decision of di State High Court, Amaewhule and odas carry dia mata go appeal court.

Source