Spain vs Germany Euro 2024 quarterfinal preview

Musialla and Williams

Getty Images

Football fans around di world no fit to wait for dis clash between Spain and Germany for di quarterfinal of di 2024 Euros.

Di two teams dey fight for semi-final spot but dem gatz to face each oda for wetin pipo describe as ‘blockbuster’, Friday evening.

For some, dis na di real test for both teams as Germany don waka thru di group stage to di knockout without wahala.

Di hosts beat Scotland 5-1 for dia first game bifor dem sama Hungary 2-0, wia dem draw 1-1 wit Switzerland.

Germany now beat Denmark 2-0 for di R16.

Spain na di only team wia gat perfect record for di group stage.

Dem beat Croatia 3-0 for dia first group game, bifor dem beat defending champions Italy 1-0, wit di last game vs Albania ending 1-0.

For dia R16 game, Spain whip Georgia 4-1.

Now La Roja gat to face dia biggest test for di competition – Germany wia many tip as favorites.

Both teams get young players wia dey shine so far, dia coaches also bin get plenty accolade say dem dey fit manage dia squad wey dem dey get results.

Also both teams gat three Euro titles each – and for dis tournament dem gat di most attempts on target wia dem don dey lead di way in terms of ‘passing accuracy.’

Between dem, dem swallow only three goals so far but di two coaches sabi say dis game mean for dia chance to win di tournament.

Luis De La Fuente tok say “we dey very ambitious and we wan continue to accomplish tins and achieve our goals.”

“We sabi say we dey meet anoda football powerhouse, but we dey believe in our serf.”

De La Fuente add say “wit all due respect to all di oda teams, we gat di best team and di best players – but e mean say we go win am? No. We gat to fight for it.”

Rodri and players

Getty Images
Spain scatter Georgia 4-1 for dia R16 game

For Germany coach Julian Nagglesman, im team gatz to dey prepared for di challenge.

“We gat plenti quality wit many approach to fight team wia like to possess di ball. Spain go suffer to adapt sake of we too we love to keep di ball,” Nagglesman tok for pre-match press conference.

Im add say “Spain dey try to press very high when dey lose di ball but also dey take risks wia we fit to find solution for those kind situations.”

Germany Captain Ilkay Gundogan believe say na match of equals.

“Di two teams dey play di best football for di tournament. Las las e go come down to who go deal wit situations without di ball, better wey dem no go panic.”

Gundogan go face former club teammate Rodri (Manchester City), and Barcelona teammates Lamin Yamal, Pedri and Ferran Torres for dis game.

Rodri know say Germany for dia home go dey strong, but im and im team no dey fear.

“We gat our own weapons wey we gatz to play fantastic game, if we want progress. We go go all out to win dis game,” di Manchester City midfielder tok.

Musiala

Getty Images
Di germans don score di highest number of goals (10) so far for di tournament

Spain vs Germany team news

La Roja gat almost all dia squad available for dis game – Luis De La Fuente don rest ten of im players for dia final group game vs Albania.

Lamin Yamal and Nico Williams make set to begin di game wit Rodri for di midfield.

Germany gat Jonathan Tah wey dey return afta im miss di 2-0 win ova Denmark sake of suspension.

Toni Kroos go continue for midfield – as Nagglesman go figure whether Leroy Sane or Florian Writz go start.

For Spain, Carvajal, Le Normand, Morata and Vivian go miss dia next match if dem get yellow card for dis game wia dem progress to di semifinals.

Andrich, Rudiger and Mittelstadt also go miss di next match for Germany if dem get yellow card for dis game wia dem qualify for di semifinals.

Players to watch

Spain gat rich talent for Nico Williams and Lamin Yamal for di wings.

Di two young players between them gatz one goal and 3 assists for di tournament.

Williams also bin get 100% pass accuracy wia im im score and grab assist for di same game for di tournament.

Im also gat 7 goal attempts.

Germany for dey careful about im speed and trickery for di wings.

Same for 16-year-old Yamin Yamal wey get 11 attempts wit 79.75% pass accuracy.

Rodri go battle Toni Kroos for midfield.

Kroos play all 4 games for Germany wia im get 95.75% pass accuracy.

Im counterpart – Rodri bin play 3 games wit one goal and 93.34% pass accuracy.

Germany dis poster boy na Jamal Musiala.

Di 21-year old Bayern Munich midfielder dey lead di goal king chart with 3 goals from 4 games with 92% pass accuracy.

Im na Nagglesman im weapon so far for dis tournament wey im go hope say Musiala go get good game vs Spain.

Possible lineups

Spain XI: Unai Simon; Carvajal, Le Normand, Laporte, Cucurella, Pedri, Fabian Ruiz, Yamal, Williams, Morata

Germany XI: Neuer, Kimmirch, Rudiger, Tah, Raum, Andrich, Kroos, Musiala, Gundogan, Wirtz, Havertz

Di game go happun for Stuttgart Arena at 5PM WAT. We go bring una live commentary for hia.

Source