Manchester City get ogbonge victory, reduce Arsenal Premier League title hope

Tottenham vs Manchester City

Getty Images
Erling Haaland score two goals as Tottenham lose to Manchester City

Second Half

Full Time Tottenham 0-2 Manchester City

90+11′ Referee blow whistle, match don end.

90+7′ Tottenham don wake up, dem don begin hold ball as dem dey find chance to strike.

90+7′ Julian Alvarez of Manchester City wey just enta don commit foul.

90+5′ Substitution for Manchester City Erling Haaland don comot Julian Alvarez replace am.

90+3′ Substitution for Tottenham Mickey Moore replace James Maddison

90+1′Tottenham 0-2 Manchester City

90+1′ Goal! Erling Haaland score from di penalty

90′ Ten minutes added time!

88′ Poor challenge for Pedro Porro of Tottenham, Penalty for Manchester City.

87′ Heung-Min Son get one-on-one wit goalkeeper but e no fit score.

85′ Pierre -Emile Hojbjerg don comot Oliver Skipp don enta.

85′ Substitution for Tottenham, Giovani Lo Celso don enta for Pape Matar.

83’Manchester City don collect ball back from Tottenham dem dey play shot short passes dey wait for chance to strike.

82′ Manchester City dey control di ball now wit short short passes, but dia last pass long pass toward goal post go land for Tottenham player leg.

80′ Rodri of Manchester City make one bad challenge, Referee blow foul.

79′ James Maddison take di corner kick wit short pass.

78’Pedro Porro of Tottenham play one cross wey e lift from ground into di box but defenders block am. Dem get corner kick.

76′ Tottenham dey hold dey ball wit dia short short passes near Manchester City goal area.

74′ Phil Foden of Manchester City take corer kick afta one of di defenders clear di ball.

71′ Mateo Kovacic don collect Yellow card.

69′ Kevin De Bruyne don comot too Jeremy Doku don replace am.

69′ Substitution for Manchester City, Stefan Ortega dey replace Ederson wey be dia goalkeeper, e no fit kontinu again sake of injury.

66′ Manchester City goalkeeper Ederson don recover fully, e don dey waka well afta one injury scare.

66′ Relief for Cristian as di Referee no add any oda punishment to am afta e check VAR.

63′ Referee blow whistle sake of foul wey Cristian Gabriel Romero cause, e collect Yellow card .

63′ Referee stop game sake of knock wey Manchester City goalkeeper Ederson collect, physio enta to treat am.

62′ Di corner kick wey comot from Maddison header land for defender head wey also head am comot.

61’James Maddison of Tottenham send one cross into di box but defenders head am comot.

60′ Kelvin De Bruyne don enta field back, be like di injury no too serious.

58’Kelvin De Bruyne of Manchester City dey down wit injury, referee stop di game make e receive treatment.

57′ Pape Matar of Tottenham don collect Yellow card for foul.

55′ Substitution for Tottenham, Rodrigo Bentacur don comot Dejan Kulusevski don replace am.

52′ Tottenham 0-1 Manchester City

52! GOAL! Erling Haaland of Manchester City create space for imsef inside di box as e get pass from Kevin De Bruyne, e just play low ball into di middle of di net.

49′ Heung-Min Son of Tottenham trap di ball wit half pass e fire shot toward di middle of di goal post but goalkeeper save am.

47′ Kelvin De Bruyne of Manchester City no get luck at all wit di ball wey hit goal post con bounce back for di edge of di box. Goalkeeper Guglielmo Vicario stop di ball make e no enta inside di right corner of di goal post.

46′ Referee blow whistle second half don start

Tottenham vs Manchester City

Getty Images

First Half

Tottenham 0-0 Manchester City

45+1 Referee blow whistle, first half don end.

45′ Manchester City player Erling Haaland fire shot inside di box but defender clear di ball sharp sharp.

43′ Kevin De Bruyne take di freekick for Manchester City wit beta long pass wey land for Edeson Tottenham goalkeeper hand.

40′ Pape Matar Sarr of Tottenham use force tackle Manchester City player, Refreee blow whistle to signal freekick.

39′ One high pass meet Josko Gvardiol of Manchester City e fire shot wey go ova di bar, di ball go off di pitch and na goal kick for Tottenham.

36′ Rodrigo Bentacur of Tottenham don collect Yellow card afta im bring down Manchester City player.

34′ Heung-Min Son get di ball from di corner kick, im try to curl am pass di goalkeeper but e go wide off di goal post. Na goal kick to Manchester City as di ball go out of play.

34′ James Maddison take di corner kick as im dey try find di head of im team mates.

33′ Brennan Johnson of Tottenham beat di defender inside di box, im fire beta shot toeard di bottom left corner but Ederson make save di ball. Referee award corner kick to Tottenham.

31’Manchester City players dey play short shaort pass to near Tottenham goal area.

29’Van de Ven of Tottenham play trow-in but e land for Manchester City player leg.

27′ James Maddison of Tottenham take di corner kick sharp sharp wit short pass.

Tottenham vs Manchester City

Getty Images

26′ Cristian Gabriel Romero of Totenham make attempt to create chance to score wit one beta long ball out of di penalty area. Referee signal corner kick to Tottenham.

24′ Mateo Kovacic of Manchester City dey careless as e challenge one Tottenham player, Referee blow whistle for foul.

22′ Kyle Walker of Manchester City try to slide di ball thru to one of im team mate but defender block am.

21’Rodrigo Bentacur of Tottenham cause foul sake of one yeye challenge.

18′ James Maddison go take di corner kick but notin come out from am.

18′ Brennan Johnson of Tottenham lift di ball into di box ova di defence but one odf di defenders clear di ball sharp sharp. Tottenham get corner kick.

17′ Referee blow offside for Heung-Min Son of Tottenham.

16′ Save! Phil Foden of Manchester City fire beta shot towards di left side of di goal post but5 goalkeeper save am.14′ Kyle Walker of Manchester City create space for imsef to fire di ball inside di net, but defender clear am, Manchester city get corner kick.

12’Manchester City players hold di ball and dem dey play short short passes to open Tottenham defence.

Tottenham vs Manchester City

Getty Images

10′ Bernado Silva of Manchester City bring Tottenham player down wit side tackle . referee Chris Kavanagh stop di game to give am warning.

9′ Line give signal say Kyle Walker of Manchester City dey offside, referee don confirm di decision.

7′ James Maddison of Tottenham fire one beta cross from di corner into di box but defender block am.

6′ Rodrigo Bemtancur of Tottenham wire one shot from di edge of di box. Di shot fly go towards di roof but Ederson block am. Tottenham win corner kick.

5’Tottenham players dey do short short passes to try open up di Manchester City defence to hit dem sharp sharp.

3′ Erling Haaland of Manchester City commit foul, referee blow whistle against Haaland

2′ Manuel Akanji of Manchester City no allow im opponent collect ball from im leg, but referee blow whistle for foul.

1′ Referee don blow whistle and match don start

Wetin dey at stake?

If Tottenham win or draw against Manchester City, e go put Arsenal for front position to finish ahead of defending champions Manchester City.

Arsenal currently get one-point advantage on top of di table, but dem don play one game pass City.

City fit return to top position if dem win Tottenham away from home, e go come remain only one match to end di season.

Meanwhile, Tottenham dey chase Aston Villa wey dey fourth position, dem also dey behind Spurs by four points, wit Champions League spot on di line.

Wetin Postecoglou tok

Dis position don put Tottenham for tight corner, sotay dia fan dey confuse about who dem go support.

But dia Manager, Postecoglou dey clear about wetin im tink about di match.

“I understand rivalry. I bin dey part of one of di biggest ones for di world in di last couple of years wit Celtic and Rangers,” di Spurs oga tok.

“But I neva, and will neva, understand if someone want dia own team to lose. No be wetin sport dey about. No be wetinI love about di game.”

Postecoglou believe “100% of Spurs supporters” want make im side win against City but im agree say “pipo dey allowed to feel di way dem dey feel”.

Di 58-year-old Australian, however, tok say im no dey “live my life” to take “pleasure from wetin oda pipo dey suffer”.

Im add say “Real success looks like trophies. Anytin else wey dey between, bragging rights, anytin else, dey absolutely meaningless to me.

“Wetin you tink say go happun? Wetin you tink say we go do as a team or any team for dis planet? You no tink say we go just try to win? Na simple basis. I no care how e make pipo feel and I no really care.”

Wetin Pep tok

City boss Pep Guardiola tok about how importance di result on Tuesday go be for dem.

Im say anytin oda dan victory against Spurs mean say dem don troway di chance to win dia fourth successive English top-flight title back to back.

City don win seven games in a row and dem neva lose any Premier League match since December.

Meanwhile Spurs’ victory over Burnley on Saturday na dia first in five outings.

“Di mindset dey easy because if we no win, we go lose di Premier League title” Guardiola tok.

“E dey obvious, na only one option we get, win di game. Na di reason why we travel.”

Guardiola side bin dey a similar situation wia dem hold on till di last day to win di title for 2018-19 and 2021-22 wit only one point.

On di two occasions Jurgen Klopp Liverpool push City all di way to di final game of di season.

Line-ups

Tottenham Hotspur starting 11: Vicario, Pedro Porro, Romero, Dragusin, Van de ven, Hojbjerg, Bentancur, Sarr, Maddison, Son, Johnson

Manchester City starting 11: Ederson, Walker, Akanji, Dias, Gvardiol, Rodrigo, Kovacic, De Bruyne, Bernardo, Foden, Haaland

Dey refresh dis page for live updates

Source