Mbappe go head to head wit de Bruyne for France vs Belgium Euro 2024 R16 game

E go be a wrestle of two of giants on Monday evening wen France and Belgium go do battle to know who go qualify for di quaterfinal of di Eur0 2024 tournament wey dey go on now for Germany.

France and Belgium dey ranked second and third for di current Fifa rankings, but di two teams neva shine so far in di tournament as pipo expect.

Di two kontris finish for second place for dia groups – Austria top France for group D while Romania finish ahead of Belgium for group E – dia encounter na one wey expectations dey very high becos one pesin must go to di next round and di oda go enter plane – or train – go back home.

Kylian Mbappe, di talisman for France neva find form so far for di tournament, na only one penalty goal e don score, for di 1-1 draw wit Poland, and di broken nose wey im get for dia first match no help matters.

Mbappe dey play di rest of di tournament wit a mask to protect di nose, and e don tok say to play wit mask dey “absolutely horrible”.

“E dey limit your vision and e dey sweat block sweat from running down, so you gatz remove am (from time to time) to let sweat run away,” e tok.

Di oda goal wey France don score for Euro 2024 na own goal for dia first match wit Austria, which mean to say France neva score from open play for di tournament.

Belgium also no dey do any beta. Dem lose one, draw one and win one for dia three group matches, and manage to place second on goal difference for group wey all di teams dey tied on four points afta three games.

But Belgium coach Domenico Tedesco believe say di chances wey dem dey create go make luck turn for dia side.

“Di quality and quantity of chances we bin create for di first three games dey unbelievable. E dey unbelievable say we score only two goals for di three games, and France too, but dis na football.”

Dia captain, Kevin De Bruyne, dey struggle to make di same impact for Belgium wey e get for im club Manchester City, as e help dem win dia fourth consecutive Premier League trophy dis season wey just end.

Also, striker Romelu Lukaku go beg di gods for beta luck as VAR don cancel all di three goals wey im bin score so far for di tournament sake of offside.

Match Stats

Dis go di be 76th meeting betwin France and Belgium. Di match go start by 5pm Nigerian time.

France don win all four of dia matches wit Belgium for a major tournament. Di most recent na di 1-0 victory for 2018 World Cup semifinal.

Di last time dem meet for Euros na 40 years ago, in 1984 – France bin win 5-0 for di group stage.

France don score only two goals for Euro 2024 group stage, and na di fewest goal dem dey score for di group stage of a major tournament since di 2010 World Cup.

Belgium don reach di knockout stages of a Euros tournament for di third consecutive time, and dem don win dia last four last-16 games for a major tournaments.

Source