South Africa vs Nigeria prediction, team news

Di reigning women African champions, South Africa go play Nigeria on Tuesday evening for di second leg of di CAF Women Olympic qualifier match.

Nigeria Super Falcons win di first leg 1-0 for Moshood Abiola stadium for Abuja on Friday.

Super Falcons captain Rasheedat Ajibade score di only goal for di match from penalty kick afta South African player Noko Matlou foul Chiwendu Ihezuo inside di box.

Na Ajibade don score Nigeria last two goals against Banyana Bayana.

She score di consolation goal for Super Falcons 2-1 defeat wen dem bin face each oda Rabat for July 4, 2022.

Di gap between dis two teams no big like im bin dey for 1990’s wen di Super Falcons bin flog Bayana 7-1 in front of dia own fans for Johannesburg for 1995 FIFA Women’s World Cup qualifying match.

Tori be say Banyana still neva win Falcons for any match wey dem don play for South Africa.

Dis two team don play each oda 24 times (seven for inside South Africa), Nigeria don win 15, five end for draw and South Africa don win four times.

South Africa four wins na for Bata, Equatorial Guinea (1-0, 2012 Women AFCON); Cape Coast, Ghana (1-0, 2018 Women AFCON); Lagos, Nigeria (4-2, Aisha Buhari Cup) and; Rabat, Morocco (2-1, 2022 Women AFCON).

Meanwhile Nigeria seven previous matches inside South Africa, see Falcons win five and draw two.

Di two draws happen 12th March 2004 (Athens Olympics qualifier which ended 2-2) and a friendly match on 3rd June 2012 that ended 1-1.

Nigeria neva take part for di Women Olympic Football tournament since 2008.

Di winner of dis tie go pick di women Olympic football tournament ticket wey go hold for Paris.

Dis na eviritin you need to know about dis ogbonge women match.

What time be South Africa vs Nigeria match?

Di kick off time for di CAF Women Olympic qualifier match between Nine-time African champions Nigeria and reigning African champions South Africa na 6:30pm West Africa Time.

Na for Pretoria Loftus Versfeld arena be di venue for di second leg.

South Africa vs Nigeria prediction

Joshua Adetunji say: ‘’Dis na ogbonge game between Africa most successful team, Nigeria Super Falcons and di reigning African champions South Africa’’

‘’Nigeria win di first leg by slim margins, so dem get small edge ova South Africans’’.

‘’Dia task dey clear, avoid defeat for Pretoria and secure a place for Paris Games’’.

‘’For South Africa, e dey very tricky for dem, dem need at least a 1-0 win to force di fixture into a penalty shootout or any two-goal margin victory to qualify.

Prediction: 1-1.

South Africa vs Nigeria Team news

Wetin South Africa coach Desiree Ellis tok about di game against Nigeria: “We better pass wetin we show for Nigeria”.

Super Falcons captain Rasheedat Ajibade say: “Dis na big and tough fight. For us, we get 90 minutes wey dey stand between us and di ticket to Olympics and we go give our all.

“We want Nigerians to believe di Super Falcons. Di players dey motivated to play for Olympics. Personally, I don play for every tournament you fit think of, except di Olympics. Di time to do am na now.”

Nigeria go still dey without dia key defender Ashleigh Plumptre wey bin miss di first leg sake of injury.

Nigeria team news

Goalkeepers: Chiamaka Nnadozie, Tochukwu Oluehi, Linda Jiwuaku

Defenders: Jumoke Alani, Osinachi Ohale, Chidinma Okeke, Shukurat Oladipo, Michelle Alozie, Nicole Payne

Midfielders: Rasheedat Ajibade, Toni Payne, Deborah Abiodun, Jennifer Echegini, Christy Ucheibe, Halimatu Ayinde

Forwards: Uchenna Kanu, Gift Monday, Omorinsola Babajide, Ifeoma Onumonu, Esther Okoronkwo, Chiwendu Ihezuo, Asisat Oshaola

South Africa team news

Goalkeepers: Kaylin Swart, Katlego Moletsane, Regirl Ngobeni

Defenders: Karabo Dhlamini, Fikile Magama, Tiisetso Makhubela, Lonathemba Mhlongo, Bambanani Mbane, Noko Matlou, Lebohang Ramalepe, Bongeka Gamede

Midfielders: Linda Motlhalo, Refiloe Jane, Sibulee Holweni, Sinoxolo Cesane, Nomvula Kgoale, Nonhlanhla Mthandi, Amogelang Motau

Forwards: Gabriela Salgado, Jermaine Seoposenwe, Noxolo Cesane, Hilda Magaia, Themba Kgatlana, Nthabiseng Majiya

Where to watch South Africa vs Nigeria

For now Nigeria football federation neva tok weda di match go dey live for television.

But di oda Super Falcons Olympic qualifying match NFF YouTube channel bin show am live.

BBC News Pidgin go do live text commentary of di match

Source