Nollywood actress cry out afta she lose ova N3m – Cybersecurity expert give tips on how you fit protect your bank account from fraudsters

Ogbonge Nollywood actress Shan George don enta social media to ask Nigerians and relevant authorities to help am recova di 3.6 million naira she tok say dem transfer from her bank account witout authorisation.

Di actress tok say di incident happun on Friday 3 May and na evritin di pesin comot for her bank account.

Shan George share screenshot of di debit alert she bin receive on her Instagram page.

For anoda video she post on Saturday 4 May, di actress bin dey cry and Nigerians and oda celebrities enta her comment section to sympathise wit am.

“Di worst part be say today na Saturday and I no even fit go bank,” she tok for di video.

No be today pipo moni start to vanish from dia bank account thru mago-mago way, sotay even di Central Bank of Nigeria and oda commercial banks bin don draw pipo ear to warn dem about fraudsters.

Complains of pipo wey dey lose moni to fraudsters na wetin dey happun evritime for Nigeria.

E dey also happun well-well for different parts of di world and di pipo wey dey do dis tin na internet fraudsters, wey many pipo sabi as 419 or mago-mago pipo.

Tips to protect your bank account

Sake of di rate of dis fraudsters wey dey tiff pipo moni from dia bank accounts, BBC Pidgin follow Bankole Adekola wey be Cyber expert tok.

Im give pipo some tips on how to protect dia bank accounts from fraudsters, di tips include:

  • Dey careful about di information you share online. No give out your personal information or debit (ATM) card details, unless you sure say di website na original and e dey legit.
  • Monitor your accounts: Try to check your bank account evritime, check your bank statements and transaction history regularly to identify any activity wey you no approve. If you notice any suspicious transactions, report dem to your bank immediately.
  • Use strong password and make you dey change di password evritime. Strong password suppose dey at least 12 characters long.
  • Make di password include a mix of upper and lower case (capital and small) letters. Im advise make pipo dey use sentences instead.
  • Dey careful about di links wey you dey click for emails or text messages. If you no dey sure say di link dey genuine, check am well to see di actual Uniform Resource Locator (URL) before you click.
  • No share your account information with anybodi, even though dem be your friends or family.
  • Dey careful about di information you post on social media. Fraudsters fit use dis information to target you.
  • Enable two-factor authentication (2FA): Wenever e dey possible, enable 2FA for your bank account. Dis dey add extra layer of security by requiring a second form of verification, like unique numbers wey dem go send to your mobile device, in addition to your password.
  • Dey careful wit personal information: Stay away from unsolicited communications wey dey ask for your personal/financial information, One True Pair (OTP), or any code whatsoever.
  • Banks no go eva ask you to provide sensitive details thru email or ova di phone.
  • If you no dey sure, contact di organisation directly thru dia official website or customer service line.

Source