Dem kill two officers as Mohamed Amra escape, who be di fugitive wey France dey look for?

One search dey take place for northern France afta one prisoner escape during one deadly ambush.

Dem dey take Mohamed Amra back to jail from one court for Normandy on Tuesday wen one car jam im prison van and one toll booth.

Armed men den open fire on di vehicle and kill two officers and seriously injure three odas.

Di shooting mark di kontri first fatal attack on prison staff for more dan 30 years.

“We dey use all means to find dis criminals,” French Interior Minister Gerald Darmanin tok.

Mr Darmanin tell French media on Wednesday 15 May say di attack na act of “cold-blooded barbarity” and say around 450 gendarmes and police officers don dey mobilised for di Eure department of Normandy for “unprecedented” search.

Moment car jam French police van in ambush
The British Broadcasting Corporation

President Emmanuel Macron tell France say “dem dey do evritin to find di perpetrators”.

Meanwhile, French prison officer unions don called for walkouts at institutions across di kontri on Wednesday in support of di officers wey die.

‘No look dia eyes’: Face to face wit inmates of one secretive mega-jail

List of African kontries wey don scrap di death penalty

‘I no hate you’ – Aboubacarr Drammeh tell di man wey kill im wife and two pikin

Hundreds of staff at prison and detention centres across di kontri don dey stage work-to-rule protests, wia dem go only perform essential tasks.

For one joint statement, di unions demand urgent measures to improve staff safety – including di “drastic reduction of extraditions” of prisoners to court hearings, by promoting video-conferencing, and “overhaul” to escort levels.

One minute silence go shele on Wednesday at 11:00 (09:00 GMT), and demonstrations don dey outside of French prisons, including for Paris according to local media.

French Justice Minister Eric Dupond-Moretti tok say e go meet wit union representatives.

Manhunt

Reuters

Addressing one press conference on Tuesday, Paris state prosecutor Laure Beccuau tok say di attack take place just bifor 11:00 local time wen di van wey dey carry Amra cross di toll barrier for Incarville for di Eure region of northern France and “immediately, one Peugeot vehicle hit am from di front to stop am”.

“Men wit long guns bin get out, joined by oda armed men wey bin get out of one Audi vehicle, wey bin likely dey follow di prison vehicle.”

Dem “fire several times” at di two vehicles, killing and injuring officers, bifor dem leave di scene and take Amra wit dem.

Di Paris prosecutor tok say dem find two vehicles wey don burn for different locations on Tuesday. Belief be say na di vehicles wey di criminals use be dat.

Mr Dupond-Moretti tell reporters on Tuesday say one of di officers wey di criminals kill “leave behind a wife and two children wey suppose celebrate dia 21st birthday in two days”.

While di second officer wey die at di age of 34 leave behind a wife wey get five months belle.

Three oda officers injury for di attack. As reported by local media, Ms Beccuau tok say di three injured officers na fathers – aged 48, 52 and 55 years old.

“We go put evritin – and I mean evritin – in place to find di perpetrators of dis vile crime,” Mr Dupond-Moretti tok, and add say di perpetrators na “pipo wey no value life”.

We go find and punish dem “in a way wey dey proportionate to di crime”, di justice minister add.

Gunmen wey ambush prison van
The British Broadcasting Corporation

Who be Amra?

Amra bin dey convicted of burglary on 10 May and don dey indicted by prosecutors for Marseille for one kidnapping wey lead to death.

Im lawyer, Hugues Vigier, tell French news channel BFMTV say “e go like to believe say [Amra] no know about di plan to free am”.

“For me dis plan no match wit wetin I know of am. If e dey behind am, den I don fail to understand who im be,” Mr Vigier add.

According to some French media reports, Amra bin try to escape for im prison cell earlier dis week by trying to cut di cell bars.

Ms Beccuau, di state prosecutor for di capital, tell tori pipo say Amra don get 13 convictions. E get di first one for October 2009 wen e just be 15 years old.

Even though di now 30 year old bin no be “closely watched inmate”, di Paris prosecutor tok say im need “level three escort” to transport am.

Tori be say Amra get link to gang for di southern city of Marseille, wey don dey suffer from drug related gang violence.

But di Paris prosecutor on Tuesday tok sat im criminal record till now no get conviction for drug offences.

Source