England vs Slovakia – Euro 2024 team news & kick-off

Bukayo Saka

Getty Images

England manager Gareth Southgate say I dey “desperate to do well for my kontri”. E tok dis one as di Three Lions dey prepare to play Slovakia for dia last 16 match for Euro 2024.

England bin win Group C but only score twice in three games and Southgate and im players don come under heavy scrutiny.

But victory for Gelsenkirchen on Sunday go set dem up against Switzerland for di quarter-final. Southgate say im side no dey fear for di knockout stage.

“Dis fit be anona brilliant night to create more memories for our supporters,”im tok.

“I don play for semi-final of major tournament bifor, and manage team for semi-final and final. Tomorrow (30 June), di koko na make di team progress.

“We no suppose fear say we go lose, na about opportunity. We dey try to reach somtin wey be challenge.

“We don lose matches bifor, life go on. Di point wen you fit handle di worst you dey free to try to win di game.”

Team news

Phil Foden dey available afta im bin return home sake of di birth of im pikin.

Left-back Luke Shaw dey train again afta one long-term hamstring injury but im no dey ready to start, while Manchester United midfielder Kobbie Mainoo fit play for midfield afta im come on at half-time against Slovenia.

How to follow England vs Slovakia

Dis game go kick off by 17:00 WAT and e dey live on SuperSport.

You fit also follow live updates for BBC News Pidgin website.

Match stats

  • England don win five of dia six games against Slovakia – but, di only time dem fail to defeat dem na for Euro 2016 for dia only previous major tournament meeting – e end for goalless draw for Saint-Etienne, dat game di Three Lions get dia highest shots (29) on record for a Euro match (since 1980).
  • Slovakia bin score first for three of dia six matches against England but dem end up to lose each of dose games 2-1.
  • Dis na England third last-16 match for Euros, dem bin lose 2-1 to Iceland for 2016 and beat Germany 2-0 for 2020.
  • For just di third time, na im Slovakia go play for di knockout stages of a major international tournament. However, dem chop elimination for di round of 16 both times, wia dem lose 2-1 to di Netherlands for di 2010 World Cup and 3-0 to Germany for Euro 2016.
  • Across di last two European Championship tournaments, England don keep more clean sheets pass any oda side (7 in 10 games).
  • Dem achieve all seven of dose clean sheets wit Jordan Pickford as dia goalkeeper – di only goalkeepers wey get more European Championship clean sheets na Spain Iker Casillas (9), Netherlands Edwin van der Sar (8) and Italy Gianluigi Buffon (8).
  • Harry Kane don score six goals for im past six appearances for di knockout stages of major tournaments for England (two in two for di 2022 World Cup, four in four for Euro 2020). Im seven goals for di knockout stages overall na also di highest for any Three Lions player.

Source