How suicide bomb attacks lead to deaths of wedding, funeral guests for Borno

Nigerian soldier

Getty Images

Police for Borno State, northeast Nigeria, don confam di two suicide bomb attacks wey kill nine pipo for Gwoza local goment area of di state.

Tok-tok pesin for di police in di state ASP Nahum Daso tell BBC News Pidgin say di first attack bin shele wen one female suicide bomber wey carry pikin detonate bomb for di popular Mararaba T Junction for Gwoza.

E say na about 3pm e happun and majority of di pipo wey experience di attack bin dey come from wedding ceremony.

“Na on Saturday, so wedding celebration dey and pipo bin dey come back from different places. Di junction particularly na veri busy place, although majority of di pipo for dia bin dey come back from wedding celebration and all.

“E get one particular woman wit a baby behind her, she dey in possession of IED explosive and she detonate di bomb. So di woman, her baby and five oda pipo die, while less dan fifteen injure.”

ASP Daso say di second attack happun wen dem bin dey do prayer for di burial of pipo wey die for di first attack.

According to di police officer, barely two hours afta di first attack, anoda female suicide bomber detonate bomb and kill one pesin including herself and injure odas.

No group don claim responsibility for dis attacks.

Dis na di third time wey attackers don target pipo by suicide and explosive devices for Borno State in di last four months.

At least 10 pesin dey killed, and 20 oda wunjure on 17 April 2024 wen one commercial vehicle bin drive ova one bombing device. Tori be say na suspected members of di Islamic State West Africa Province (ISWAP).

For March 18, two pipo wunjure afta one suspected suicide bomber bin bomb wit di device wey dey im bodi. Na close to one mosque for Biu local goment area of Borno State di tin bin happun.

Di police for Borno say di incident occur around 8pm wen Muslim pipo dey observe di night prayers.

Di northeastern part of Nigeria continue to dey face severe insecurity as jaguda pipo still dey attack innocent pipo, and dis don affect di livelihood of residents of dis region.

Despite di efforts of di Nigerian military, dem still dey struggles to fully secure di area, as insurgents continue to employ guerrilla tactics and launch surprise attacks.

In response to di insecurity for di north, di Nigerian goment don launch several military operations but insurgents still dey operate.

Source