Who qualify for di conditional cash transfer palliative

Nigeria goment say di conditional cash transfer policy programme go officially begin October 17.

Na di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu confam am for interview wit tori pipo Channel Television.

Dis dey come months afta goment comot fuel subsidy.

Part of di tins President Bola Tinubu bin approve afta di announcement say fuel subsidy don go na a conditional cash transfer policy, a palliative to help poor households.

So who go benefit and how?

Conditional cash transfer policy na for eviribody?

No, di conditional cash transfer policy no be for eviribody.

To qualify for di scheme you must fulfil certain conditions.

Goment say you must dey earn under $1.95 dat na about N1500.

Dem say those wey fall under dis bracket name dey inside di National Social Register.

Goment say dem go use di informate from dat register to pay pipo di money.

Di National Social Register, na register of names of poor pipo for di kontri.

And eviri state get social register.

Although many pipo don criticize dat register sake of integrity issues.

But goment say dem dey do verification to clean up di register to make sure say di pipo wey dey dia, dia informate correct.

Dem say e get 15.7 million household and 62 million individuals for di poor pipo register for di kontri.

Di register go ready by 15 October na so goment tok.

Meanwhile, vulnerable pensioners go dey part of di scheme.

Goment say dem go need to go field, capture dem and get dia biometrics.

Afta dem finish wit dia registration den, dem go begin receive dia share of di money by November.

Wetin be conditional cash transfer policy?

Di conditional cash transfer policy, na social Intervention Scheme wey goment launch to reduce poverty for Nigeria.

Tori be say large proportion of Nigerian population dey very poor.

Na sake of dis wey make former President Muhammadu Buhari introduce dis scheme for 2016 to solve dis palava.

Goment hope say dis scheme go help beneficiaries to develop life skills, technical skills and encourage more saving groups.

Dem also hope say e go increase di beneficiaries income.

Buhari administration bin claim say di scheme reach about two million pipo.

How much goment dey pay for conditional cash transfer?

Under CCT, beneficiaries go receive monthly payment of N25,000 eviri month for three months.

In total, na N75,000 goment go pay beneficiaries and di money na for October, November and December.

Goment say di beneficiaries go collect di money for di end of di month

Dem say dem go publish di names of pipo wey benefit from di scheme for Newspaper.

Di reason why dem dey publish di names of pipo na to show say mago-mago no dey at all.

Source