Facebook Monetisation: Wetin e mean for content creators in Nigeria, Ghana?

Facebook

Getty Images

Meta, di parent company wey get Facebook, Instagram and Whatsapp, don announce say “eligible creators in Nigeria and Ghana fit dey earn money for dia video and reels content” wit effect from July 1, 2024.

Meta send out one statement on Monday wey Moon Baz sign – im one oga wey dey in charge of Global Partnerships Lead, Africa, Middle East and Turkey (AMET) for Meta.

Baz tok say “di expansion go empower eligible creators for di vibrant creative industry across Nigeria and Ghana to earn money, whilst setting di bar high for creativity across the world”.

Dis development dey come just about three months afta di President of Global Affairs, Nick Clegg, visit Nigerian President Bola Tinubu, and promise say Nigerians go dey eligible to earn money from dia Facebook content from June 2024.

Bifor now, content creators for Africa dey usually follow di back door to monetise dia pages.

One of di ways na to setup dia pages using pesin wey dey live for kontri wia facebook monetisation dey available.

To dey eligible for dis monetisation, “di creator must pass and remain compliant wit Facebook Partner Monetisation Policies and Content Monetisation Policies” Meta tok for di statement.

How to dey eligible

According to Meta, pesin must dey above 18 years old bifor your page go dey eligible for monetisation.

Di oda requirement include:

  • Di pesin go dey live for kontri wey dey eligible for in-stream ads.
  • You go get minimum of 5,000 followers
  • Your videos go get 60,000 total minutes viewed in di last 60 days. Dis no include minutes viewed from crossposted, boosted or paid watch time.
  • Your page go get at least five active videos
  • No be all types of videos dey eligible. Static videos, static image polls, slideshows of images, looping videos, videos wey get embedded ads, etc, dey prohibited

Requirements for live videos na:

  • Minimum 10,000 followers
  • 600,000 total minutes viewed for di last 60 days wit at least 60,000 minutes of di 600,000 total minutes viewed from live videos.
  • Page go get at least five active videos, including at least three previously live videos wey you don create.

Also content wey get death, sexual activity, strong language, explicit content, misinformation, and misleading medical information no dey allowed.

As social media dey bicom bigger, content creating don bicom a career path for many young pipo for Africa in di last one decade.

E don throw up many young pipo who are now larger dan life celebrities for across di kontinent, and earning good money not only from dia content but also from brand endorsements.

Some young pipo don also use social media content creating to launch dia careers as big comedians, actors, film makers, musicians and even talk show hosts.

Nigeria popular creator and comedian, Emmanuel Ejekwu (Oga Sabinus) bin start im career posting comic videos for instagram and facebook, now im brand don big sotee afrobeat superstar Burna Boy invite am for stage during im performance for di Glastonbury Festival – arguably UK biggest music festival – on Sunday, June 30.

Similarly, Ghana Akwasi Boadi (Akrobeto) blow afta im comic videos of reading sports news go viral on youtube and instagram, attracting attention from top football clubs and stars for Europe.

Source