Voting don start for Liberia as George Weah face Joseph Boakai for ogbonge election

Pesin wey dey vote for Liberia

BBC

Liberians dey vote for inside ogbonge contest for dia presidential election, as former football star George Weah, 57, dey run for second term.

Im main competition na former Deputy President, 78 year old Joseph Boakai, 78.

Oga Boakai bin dey run im campaign under di slogan, “Rescue” say di West African state bin crash for oga Weah first six years for office.

But oga Weah dey confident say e go win sake of say, according to am, ee keep Liberia stable and don improve education.

Dis na di first time wey di generation of young voters wey dem born for peace-time Liberia go vote for president.

Two decades ago na wen di brutal civil war wey kill around 250,000 pipo bin end.

Many Liberians dey ginger for dem to build war crimes court wey go bring di key figures behind di kasala to justice. Dem say to no do am go create culture of impunity.

Oga Weah don resist di pressure so far, say to focus on old crimes no be di best way to achieve development.

Oga Boakai wit two oda leading candidates, businessman Alexander Cummings and human rights lawyer Tiawan Gongloe, don promise say dem go set up di court.

George Weah supporters

Reuters

About 2.4 million pipo na im dey registered to vote for di elections.

Na 19 candidates wey include women dey run for di office of president against oga Weah.

Weah bin take ova power for di first elected female president for Africa, Ellen Johnson Sirleaf, afta she finish her two terms for 2018.

Voters go also vote for dia parliamentary representatives for di election on Tuesday.

George Weah

BBC

Liberia main parties don promise say dem go maintain peace during di elections even though for di last dayys of campain rival camps bin dey clash with gbas-gbos.

For September, three pipo bin die on top election related kasala.

Oga Weah wey be di 1995 Fifa World Player of di Year enta politics afta im retire for football.

E bin win im first term for 2017 wit 61% of di vote for run-off wit oga Boakai who bin dey work as Ms Sirleaf deputy.

Analysts say dis fit be di last time di 78 year old go run for president.

Mr Boakai opponents don nickname am “Sleepy Joe” say i dey allegedly doze off for public events.

Joseph Boakai supporters

EPA

E present imself as regular, honest man from modest background and don dey yab Oga Weah administration tay-tay.

Oga Boakai don promise say im go improve infrastructure, invest for agriculture and strengthen tourism.

E also accuse oga Weah say im no try at all to comot corruption.

For 2018, one Liberian court bin issue arrest warrants for more dan 30 former central bank officials sake of say $104 bin lost. And last year, George Weah sack three senior officials wey include im chief of staff, afta US goment sanction dem say dem dey do corruption. Dem disagree say dem no do anything wrong.

Oga Weah say no be true say im no fulfil im 2017 campaign promises, e say e don do ogbonge tins, wey include free tuition for university students.

E don promise say e go kontinu economic reforms if e dey re-elected like to create more jobs.

Di World Bank say last year, Liberia economy bin grow by 5%.

But di UN development agency say 52% of di population dey live inside poverty and anoda 23% dey close to enta poverty.

More dan 60% of Liberians dey under di age of 25.

Source