Budget of First Lady scrapped as Kenya President William Ruto announce cut for cost of governance

Kenya president William Ruto

EPA

Kenya President William Ruto don announce some measures im administration go take to cut down di cost of governance for di kontri.

For one televised news conference for Nairobi, di Kenyan capital, Oga Ruto announce di dissolution of 47 state corporations wit overlapping functions.

Oda measures include:

  • Suspension of di purchase of new vehicles for state officials for six months
  • Suspending all non-essential travel for state officials
  • Reduce goment advisers by 50%
  • Scrap di budget for first lady and spouses of deputy president
  • Enforcing the retirement of public servants at di age of 60.

President Ruto bin start im speech by expressing condolences but say dis “difficult time” na opportunity for di kontri:

“We finally dey get di right conversation, not about our tribes, or personalities, or political formations, but rather issues wey dey affect each and every one of us: issues like taxation, debt, di budget, corruption, di cost of living, unemployment, and opportunities for our young pipo.”

E make di announcement ahead of one historic public online forum wia e wan follow anti-tax protesters on social media platform X Spaces tok.

Im daughter Charlene bin don tweet to publicise di three-hour opportunity to chat directly wit di president. E describe am as “di first ever president for di world to hold online meeting wit all Gen Z.

“Young pipo, di chance of a lifetime await you,” she bin post.

“I encourage you to use am wisely and engage constructively becos na una be di ones wey go determine di continuity of dat kain levels of discussion for your success.”

Source