Euro 2024 last-16 permutations & third-place table

Euro 2024

Getty Images
Kevin de Bruyne Belgium need just one point to book dia last-16 spot

Every team now don play at least two games for Euro 2024 and di last-16 line-up don dey take shape.

Di top two teams for all six groups go qualify automatically, di four best third-placed teams go join dem.

As di final round of fixtures go end on Wednesday, dis na wetin teams need to progress.

Group A – Germany and Switzerland don qualify

Euro 2024 table

Getty Images

Scotland don comot for Euro 2024 afta dem finish for bottom of Group A sake of di last-minute winner by Hungary for dia final group-stage match.

Germany top di group, while Switzerland progress to di knockouts for second position.

Hungary fit still reach di last 16 as one of di four best third-placed sides, but dem go need to wait for di rest of di group-stage games to finish bifor dem go know if dem go make am or not.

Group B – Spain and Italy qualify for last 16, Croatia go need wait

Euro 2024 table

Getty Images

Spain qualify for di last 16 as group winners wit one game to spare.

Italy follow dem for back as di second team sake of Mattia Zaccagni injury-time equaliser against Croatia.

Croatia for qualify if not for di late equaliser, but dem still get slim hope to still end up as one of di best third-placed teams. England draw wit Slovenia on Tuesday fit don spoil tins for dem.

Group C – England qualify as group winners despite dia draw

Euro 2024 table

Getty Images

England qualify for di last 16 as group winners even though dem fail to beat Slovenia for dia final group game.

Di Three Lions win Group C despite dia 0-0 draw on Tuesday, as Serbia and Denmark game end goalless too.

Denmark finish second and qualify automatically while Slovenia carry third but dem do enough to qualify as one of di best third-place teams.

Di Danes and Slovenia finish level on points, wit di same goal difference and goals scored – but Denmark go through becos Slovenia collect one more yellow card pass dem (7-6).

Meanwhile Serbia finish bottom of Group C, dia tournament don end.

Group D – Austria, France and Netherlands qualify

Euro 2024 table

BBC

Austria overtake France and di Netherlands to top Group D wit dia 3-2 victory ova di Dutch for dia final group game.

Dem go play di Group F runner-up for di last 16, while France go jam di runner-up for Group E.

Di Netherlands qualify as one of di best third-placed teams but dem go need to wait for di rest of di group stage to finish before dem find out who dia opponents go be.

Poland don already comot before Tuesday fixtures, na dem be di first team to chop elimination from di competition sake of France draw wit di Netherlands on Friday.

Group E – Everybody hia get three points

Euro 2024 table

BBC

Di situation for Group E get as e be for everybody based on say all of dem get three points afta two games.

Dis na di first time for di history of Euros wey all four teams dey on di same amount of points afta two games.

All four teams know say if dem win on Wednesday e go take dem to di last 16 – but no team go dey sure of di top spot wit a victory.

A point go dey enough for Belgium, Romania and Slovakia – di last two dey play each oda.

If both games end for draw, Ukraine go chop elimination even though dem get four points as dis go mean say dem finish for bottom on goal difference.

Matches wey remain

  • Ukraine v Belgium (Wednesday, 17:00 WAT)
  • Slovakia v Romania (Wednesday, 17:00 WAT)

Group F – Portugal qualify as group winners

Euro 2024

BBC

Portugal qualify for di last 16 as group winners.

Turkey go also qualify to di knockouts if dem avoid defeat against di Czech Republic.

But, if di Czech Republic win dat game, den na dem go qualify, Georgia fit also advance if dem beat Portugal. A combination of those two results fit eliminate Turkey.

Di Czechs and Georgia, wey get one point so far, go dey rely on oda group outcomes if either of dem finish third on two points.

Matches wey remain:

Czech Republic v Turkey (Wednesday, 20:00 WAT)

Georgia v Portugal (Wednesday, 20:00 WAT)

How about di third placed teams?

Euro 2024

BBC
Dis na how di ranking of di thrid-placed teams stand as at 12:00 noon on Wednesday

Euro 2024 round of 16 Fixtures

Di knockout round of di ongoing Uefa Euro 2024 football tournament go start on Saturday 29 June.

  • Switzerland vs Italy
  • Germany vs Denmark

Di remaining round of 16 fixtures go dey known by di end of matchday three on Wednesday 26 June.

How dem go split two teams wey finish level on points?

  1. Head-to-head results between team or teams
  2. Head-to-head goal difference
  3. Head-to-head goals scored
  4. Overall goal difference
  5. Overall goals scored
  6. Lowest disciplinary points total (red card = 3 points, yellow card = 1 point, two yellow cards in one match = 3 points)
  7. Ranking for qualifiers

Source