Nigerian Navy release and fire Seaman Abbas Haruna?

Nigeria Navy Seaman, Abbas Haruna, wey allegedly chop detention for nearly six years sake of order from one senior Navy officer, don regain im freedom.

On Friday, Hussaina and her husband bin come local news channel, Brekete Family, to announce im release.

Tori of di hardship wey Seaman Haruna and in wife take dia eyes see for six years, bin finally bin dey exposed afta two of dem appear for one local news channel Brekete Family.

Hussaina Iliya, wife of Haruna bin dey cry, wit shake shake voice as she tok how dem kick her husband out, carry am comot for gate.

She bin cry as she bin dey tok wetin happun sotey her husband Seaman Haruna stand up, hug am, begin beg am make she no vex.

“Shebi I don tell you make you no vex? You too dey cry,” Haruna tell im wife.

She bin first tell di Brekete Family say di military bin detain her husband since 2018 for no reason.

Dat time, Madam Hussaina accuse one senior military officer of ordering her husband detention and torture.

Her claim bin go viral, sotey Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, and Minister of State for Defence, Bello Matawalle, give order for investigation into di mata.

Days later, di Defence Headquarters tok say dem no arrest Haruna.

But for one video wey go viral, e show wia di embattled Seaman dey actively resist as some military personnel dey try collect im weapon, and dem later fire several shots.

Military fire Seaman Haruna?

BBC bin tok to di Nigerian Defence Headquarters tok-tok pesin, Brigadier General Tukur Gusau, to find out wetin dey happun to Seaman Abbas. Im still dey work for di military or dem don pursue am?

“Yesterday dem release am and come fire am,” Brigadier General Tukur Gusau tok.

According to di tradition of military service plus oda goment service for Nigeria, if dem dismiss pesin from im work, dem no go give am im rights.

Only di military court get right to dismiss pesin from military service for Nigeria.

E neva clear weda dis na di final result from di Chief of Defence Staff investigation.

Wetin happun to Seaman Abbas Haruna?

For one video clip, Abbas Haruna wife bin dey tok how dem bin give her husband extraordinary punishment.

She bin tell Brekete Family say di military bin no dey fair for di way wey dem treat some of di accuse against her husband and im family.

Hussaina say kasala bin burst between her husband and one senior navy officer, wey oder make dem arrest and detain am. According to her, dis detention last for almost six years.

Dis video make pipo para wella for social media, some insult, some curse, some condemn God join, and odas bin call for investigation.

Source