Uefa Europa League standings, results and fixtures

Uefa Europa League

Getty Images

Di new format of di Uefa Europa League start on Wednesday wit di match between Manchester United and Twente among many games on di night.

But di small Dutch clubside shock di Red Devils for Old Trafford as di match finish 1-1.

Cristian Eriksen na both di hero and villain for di match as e score Man Utd goal but also give di ball away wey cause di equaliser.

For oda matches, Nigerian star Victor Osimhen kontinue to dey do well for im Turkish club Galatasaray as dem face PAOK FC of Greece.

Osimhen force PAOK defender Baba Rahman to score own goal, and e also set up anoda goal for Yunus Akgün.

Anoda Nigerian, Fisayo Dele-Bashiru also enta di scoresheet as e score di second goal for im club Lazio to beat Dynamo Kyiv 3-0 away.

Like di Champions League, di new Europa league format no get group stage rather, na team of 36 clubs wey go first play eight matches – four home and four away.

Afta di first round, di first eight teams for di table go qualify automatically for round of 16, while position 9-24 go play play-offs to know who go enta round of 16.

Position 25 – 36 go dey eliminated from di tournament.

Wednesday Results

Europa League results for Wednesday,  September 25, 2024

BBC Sport

Europa League standings

Europa League Table

BBC Sport
Europa League table

BBC Sport
Europa League Table

BBC Sport
Europa League table

BBC Sport

Thursday fixtures

Europa league fixtures for Thursday, September 26, 2024

BBC Sport

Source