Senior officers of Nigerian Correctional Service chop suspension sake of Bobrisky mata

Sake of di viral video wey bin trend on social media on alleged misconduct by officers of di Nigerian Correctional Service wey relate to Idris Okuneye aka Bobrisky, di Civil Defence, Correctional, Fire and Immigration Services Board don suspend two senior officers of di Service.

Di Board yarn dis one on Thursday for one statement as dem tok say investigation dey go on into di allegation.

Di officers wey dem suspend na senior officers of di maximum and minimum security custodial centres for Kirikiri, Lagos State, southwest Nigeria.

Secretary to di Board, Ja’afaru Ahmed, say for anoda development wey no relate to Bobrisky mata, di Board also suspend anoda pesin for Ebonyi State ontop accuse say im accompany one convicted inmate out of di Custodial Centre to one location outside di facility.

E say di Board also suspend anoda senior officer of di Service for Kuje prison wey dey for Abuja ontop accuse say im receive moni on behalf of one inmate. Also, dis particular one no relate to Bobrisky mata.

“Di suspension of dis officers na to allow for further investigation on di various allegations while assuring say di outcome go dey made public wen concluded.”

Dis dey come afta di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, direct unconditional and comprehensive investigation into di allegations of bribery and corruption within Nigerian Correctional Service (NCoS).

Wetin bin happun?

Nigerian influencer Martins Vincent Otse aka Very Dark Man for one video wey don circulate on social media bin play audio recording wey involve two pipo.

E claim say na Bobrisky and one pesin bin dey engage in conversation.

For di audio recording, di voice wey Very Dark Man say na Bobrisky own tell di oda pesin on di phone say im pay 15 million naira to unnamed EFCC officers to avoid prosecution for alleged money laundering.

Di voice also claim say di oga of prison service help am avoid spending jail term for prison, and instead na for one apartment wey close to di prison im bin dey.

For im reaction, di crossdresser on Wednesday say no be true say im pay EFCC officers 15 million naira.

“My attention don dey drawn to one fake voice recording circulating on di internet say I pay EFCC 15 million naira and say I no dey for prison,” e write on Instagram.

Bobrisky say im serve im jail term in full.

“I no pay any EFCC money, na veri big lie. I serve my term in full, and I come out. Discard any false information.”

For one statement wey BBC News Pidgin take eye see, di minister condemn di alleged behaviour and emphasise say any form of “indiscipline, unprofessionalism, and corruption go dey met zero tolerance and severe consequences within di paramilitary services under di ministry purview”.

Di minister tok say im ministry no go tolerate any compromise on dia core values of integrity, transparency, and accountability.

“We go leave no stone unturned in rooting out corruption and ensure say dose found culpable face di full wrath of di law.

“Di Minister don set up a special investigative panel headed by di Permanent Secretary of di Ministry of Interior, Dr. Magdalene Ajani, to probe dis allegations and submit a comprehensive report,” di statement tok.

Oda members of di committee include Dr. Uju Agomuoh of Prisoners’ Rehabilitation And Welfare Action (PRAWA) wey go serve as di Secretary; Mrs Eva Omatese, Director of Legal Ministry of Interior; Mr. Usman Nasiru, Director of Joint Services Ministry of Interior; and Dr. Ikechukwu Ezeugo (Consultant Iyke) of di Brekete Family Show.

For di statement, di minister reassure di public say di investigation go dey rigorous, transparent, and impartial, and say appropriate disciplinary actions go happun against any personnel wey dem find guilty.

On Tuesday, 24 September, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin release statement say dem dey investigate di mata of alleged bribery against dia officers to drop money laundering charge against Bobrisky.

“To dis end, di Commission hereby invite both Okuneye and Otse to make demsefs available at dia Lagos Directorate to assist investigators unearth di alleged bribery,” di EFCC statement tok.

Source