Five tins wey happun for Kenya bloody Tuesday protests

Kenyan protester dey display placard

Getty Images

Kenya President William Ruto don deploy di military to stop di anti-tax protest after police shoot dead over 10 protesters and a section of parliament dey set on fire as demonstrations against new tax proposals enta anoda level on Tuesday.

Inside one address on Tuesday evening, President William Ruto say all means go dey deployed to “stop any attempts by dangerous criminals to undermine di security and stability of our kontri”.

For days now, big protest don dey shele for Kenya, wey be di biggest economy for East Africa, and dis protest dey majorly organised by young pipo.

Di controversial bill, wey bin get some provisions wey pipo see as imposing extra burden on ordinary citizens and businesses, provoke di kontri pipo wey bin already dey suffer high cost of living.

We take a look at di events of Tuesday wey make Ruto call di military to chook head.

Wetin happen on Tuesday?

Di protest bin dey peaceful since e start last week. Dat time, di Finance Bill wey be di cause of di wahala still dey for parliament as di lawmakers dey consider am.

But tins come take a different dimension on Tuesday after di Kenyans MPs bin pass di bill even though dem bin comot some of di parts wey pipo tok say dey vex dem.

As new spread say dem pass di bill, angry protesters break through lines wey police bin set and enter di parliament building come put fire for inside of di complex.

Fear catch di MPs as dem dey trapped inside di building so all of dem go take cover for di basement.

Police on dia part come respond wit force, begin shoot live bullets and tear gas to try to scatter di protest.

How many pipo don die?

About 13 pipo don die so far as police respond wit force on Tuesday.

Dis na according to di Kenyan Medical Association wey also tok say two hospitals for Nairobi dey overwhelmed wit di number of pipo wey dey come wit different type of wounds.

BBC tori pipo report say dem see bodies for street and dem also see pipo wey get gunshot wounds wey Red Cross pipo bin dey give first aid.

Level of destruction

Kenyan protest

EPA

Protesters bin set one part of di Kenyan parliament building on fire.

Also some protesters match to di office of di Governor of Nairobi, Johnson Sakaja, and set am on fire.

Oga Sakaja imsef bin don condemn how police use force on di protesters in a speech on June 20, as e tok say protest na part of di Kenyan constitution.

Wetin President Ruto tok?

Kenyan President, William Ruto, wey win election on top promise say im go comot poverty and improve pipo leaving standard, don dey beta hot seat now.

For im broadcast on Tuesday evening, Oga Ruto tok say na criminals hijack di peaceful protests and use di opportunity to destroy emblems and institutions of di kontri sovereignty.

Kenya President William Ruto deploy as e tok say im don mobilise resources to make sure say sometin like dat no go eva happen again “at whatever cost”.

Ruto, however, promise say im dey welcome evri conversation about di new Finance bill, and say di “conversations no go be in vain”.

Wetin di international community tok?

Di United Nations and oda western kontries including di US and UK don chook mouth on top di matter, dem call on di Kenyan goment make dem take am easy.

UN oga kpatakpata, Antonio Guterres tok for one statement on Tuesday say im dey “very much saddened” wit tori wey dey come out of Kenya.

E tell di Kenyan authorities to respect di right of citizens to protest and to investigate any report of killings wey happen durin di protest.

Also, di US White House tok say dem dey follow closely wetin dey happen for Kenya, and dem condemn violence and call for calm.

Embassies of oda western kontris wey dey Kenya, including UK, Belgium, Canada, Denmark, Germany, Ireland, Netherlands, Estonia, Norway, Sweden and Romania also join bodi release one statement wia dem “call for restraint on all sides, and encourage all leaders to find peaceful solutions through constructive dialogue”.

Di power of GenZs

Kenyan protests dey powered by di GenZs

Reuters

E bin don happen in Nigeria wit di EndSARS protests in October 2020, wia mostly young pipo demonstrate against police brutality.

Di protests later end in a bloody way, according to a panel wey goment set up to investigate di matter, sabi pipo dey draw comparisons with dis recent Kenya protests about di willpower of young Africans.

“Di previous generations na pipo wey dem train to keep your mouth shut. Stay wit di status quo. We (GenZ’s) na generation wey be say bicos of our activities on social media we don create communities and we dey uplift each oda, and we dey call each oda out on certain tins to say dis no be how tins suppose to be. We dey question things. GenZ’s get a big voice and now pipo don dey hear am,” Nyawanga Owuor, one of di activists for di protest bin tell BBC.

Police use teargas to scatter protesters in Kenya

Reuters
Police use teargas to scatter protesters in Kenya

Source