Belgium vs Ukraine, Slovakia vs Romania – Euro 2024 Group E final games

Di final round of games for Group E inside di ongoing Euro 2024 tournament go happun today.

All four teams for dis group get chance to progress to di R16 stage.

Belgium, Ukraine, Romania and Slovakia all get 3 points from dia first two group games.

Belgium dey face Ukraine as Romania go play wit Slovakia at 5 PM WAT.

For Belgium and Ukraine, dis na di first time di two teams dey face each oda.

Kevin De Bruyne and im teammates lose 1-0 to Slovakia for dia first group game, bifor dem defeat Romania 2-0 for dia second game.

For Ukraine, dem lose 0 – 3 to Romania for dia first group E game wey dem beat Slovakia 2-1 for di second game.

Wetin dey guaranteed for dis group be say, any team wey go win, go finish for top two, wia dem go qualify for R16.

But if all di teams draw today, e go dey complicated.

Ukraine coach, Serhiy Rebrov tok say Belgium dey very strong wia dem be favourites bifor di competition don begin.

“We need to tink about how to play di game sake of we must win dis game. We get to find di balance – everibodi get to do dia work,” Rebrov tok ahead of di clash.

Di Belgium coach Domenico Tedesco tok say im go play to win di game.

“I no dey like permutations – so we suppose begin di game well well from di start wia if we get to hang on for di final ten minutes, we go try to do am.”

Belgium v Ukraine team news

Belgium striker Romelu Lukaku so far neva get a goal for dis tournament afta di first two games.

All di three goals im score, neva count (2 for offside, and di oda na as a result of a foul).

Di striker also get di highest number of misses (3) so far for di tournament.

Today, im go hope say luck go shine on am to grab a goal to help Belgium to win dis game.

Captain Kevin De Bruyne dey fit enough to start di match afta im inspire di Red Devils to a 2-0 win against Romania.

Di Manchester City midfielder score di second goal wia im win di man-of-di-match award.

For Ukraine, dem go hope say Mykailo Mudryk go fit lead im team from di front to qualify for di R16.

Di Chelsea forward also no score yet for Ukraine at di tournament.

Ukraine go also count on Girona striker Artem Dovbyk wey be top scorer for La liga last season with 24 goals, to score for dem inside dis tournament.

If any of dis two players (Konoplia, Yaremchuk) receive yellow card for dis game, dem go dey suspended for dia next game.

Lukébakio from Belgium dey suspended for dis game.

Ukraine vs Belgium Possible line-ups

Ukraine XI; Trubin; Tymchyk, Zabarnyi, Svatok, Matviyenko, Mykolenko; Yarmolenko, Shaparenko, Brazhko, Mudryk; Dovbyk

Belgium XI; Casteels; Castagne, Faes, Vertonghen, Theate; Tielemans, Onana, De Bruyne; Doku, Lukaku, Bakayoko

Romania vs Slovakia team news

Slovakia go dey count on dia top scorer Ivan Schranz (2 goals) to deliver di goals for dem against Romania.

But Romania coach, Edward Lordanescu sabi say im team dey ready to scatter everywhere.

Despite dia defeat for di weekend against Ukraine, im believe say im boys go rise to di occasion.

Slovakia coach, Francesco Calzona tok say dem be di “Cinderella team” for dis Euros, na so dem go try to qualify for R16.

If dem fit to win di group, di coach say dem go dey on cloud nine.

Romania vs Slovakia possible lineups

Slovakia XI; Dúbravka; Pekarík, Vavro, Škriniar, Hancko; Kucka, Lobotka, Duda; Schranz, Boženík, Haraslín

If Schranz collect yellow card for dis game, im go miss dia next match if dem progress to di R16.

Romania XI: Niță; Rațiu, Burcă, Drăgușin, Bancu; R Marin, M Marin, Stanciu; Man, Draguş, Coman

Romania players Bancu, R Marin and M Marin also go miss dia next game if dem collect yellow card inside dis game.

Remember say di two matches all dey happun at 5PM WAT. Join us for hia for di live text commentary.

Source