Sean ‘Diddy’ Combs don get di 11th lawsuit – Who be im accusers?

Sean 'Diddy' Combs for 2023

Getty Images
Criminal charges against Combs fit land am for prison for life

Hip-hop mogul Sean “Diddy” Combs dey currently inside federal custody awaiting trial on charges of racketeering and sex trafficking.

Im arrest last week for New York happen afta series of civil suits alleging sexual assault and physical violence, some go back to di 1990s.

Di 11th and latest accuser to come forward, Thalia Graves, claim say Combs and im bodyguard drug, bound and rape her for 2001, and dem video di incident.

Di Harlem-born rapper don deny criminal wrongdoing.

Wetin di criminal case dey about?

Authorities arrest Combs, 54, on Monday 16 September inside one New York hotel on charges of racketeering conspiracy, sex trafficking by force and transportation for purposes of prostitution.

Federal prosecutors don don accuse am of “creating a criminal enterprise” in which e “abused, threaten, and pressure women and odas around am to fulfil im sexual desires, protect im reputation, and hide im conduct”.

Dem say Combs bin use drugs, violence and di power of im status to “deceive female victims” into sex acts called “Freak Offs”.

Dem also reveal say dem get uncovered firearms, ammunition and more dan 1,000 bottles of lubricant during raids for Combs homes for Miami and Los Angeles for March.

Aerial footage shows raids for Sean ‘Diddy’ Combs properties
The British Broadcasting Corporation

Prosecutors don dey in touch with several witnesses according to reports, wey work under Combs and some of di accusers wey dey currently sue am, and dem don leave open di possibility of more charges.

Di singer-producer don plead not guilty to di three felony counts against am and im lawyer tell reporters e be “fighter” wey no dey “afraid of di charges”.

Authorities dey currently hold Combs for di Metropolitan Detention Center for Brooklyn, a federal jail wey dey notorious for im violence and poor inmate care.

MDC include an extra-security section with barracks-style housing reserved for special detainees, and US media report say Combs dey share di space with convicted cryptocurrency fraudster Sam Bankman-Fried.

Im legal team try to get im release pending trial because of di jail “horrific” conditions, but prosecutors argue say e be “a serious flight risk” and Combs don dey denied bail two times.

If convicted, e go face a sentence of anywhere from 15 years to life in prison.

Who be im accusers?

Cassie Ventura and Sean Combs for 2018

Getty Images
Cassie Ventura be Combs on-and-off girlfriend for 11 years

Combs former on-and-off girlfriend, Cassie Ventura, na di first to blow di whistle on di self-proclaimed “bad boy for life”.

Inside one lawsuit filed last November, di model and musician allege say e bin “trap” her for over a decade inside a “cycle of abuse, violence, and sex trafficking”.

Combs “strongly” deny di claims. A day afta di suit land for court, both parties say dem don “amicably” settle di case, though Combs attorney say di settlement no “in no way be admission of wrongdoing”.

But for May, CNN obtain one surveillance footage wey show di entertainer-turned-entrepreneur dey assault Ms Ventura for one 2016 fight wey dey her suit.

Combs finally admit di incident for one Instagram video two days later, saying e dey “disgusted” with wetin e bin do.

“My behaviour on dat video dey inexcusable. I take full responsibility for my actions,” e tok.

Ten odas – including one man – don since come forward with their own claims.

Joi Dickerson-Neal, wey say Ms Ventura bin inspire her to speak out, allege say Combs bin “intentionally drug” and rape her wen she be Syracuse University student for 1991, and say e make her a victim of revenge porn by filming di assault and showing am to odas.

Representatives for Combs blast di lawsuit as “purely a money grab” and don ask for am to dey dismissed.

Liza Gardner accuse Combs and R&B crooner Aaron Hall of giving her drinks and den forcing her to have sex with dem against her will wen she be 16 years old. She also claim say Combs bin visit her home di next day and choke her until she pass out. Combs attorney slam di claims as “bogus”.

Dem bring di three initial lawsuits under New York state Adult Survivors Act, wey dey grant adult victims a one-year window to bring claims against dia abusers regardless of statutes of limitation.

One woman so far identified only as Jane Doe claim say Combs, former Bad Boy Records president Harve Pierre and one third person bin violently gang-rape her inside one New York City studio wen she be a 17-year-old high school student.

A few days later, Combs break im silence on social media against “sickening allegations… by individuals looking for a quick pay day”. Im attorneys dey look to dismiss di “baseless and time-barred” case. Mr Pierre don meanwhile call di suit “story-story”.

Rodney “Lil Rod” Jones, producer and videographer wey work on Combs most recent album, accuse di mogul of running an illegal racketeering enterprise where e bin dey forced to get drugs, find sex workers and sex video acts. E also claim say Combs and actor Cuba Gooding Jr bin grope am without consent.

Grace O’Marcaigh, wey work on one yacht leased by Combs family for 2022, accuse di rapper and im son, Christian “King” Combs, of sexual assault. She blame dem for creating an “environment of debauchery” with suspected sex workers and top celebrities aboard.

Crystal McKinney claim say she been dey drugged and sexually assaulted by Combs afta one Men’s Fashion Week event for 2003 wen she be 22 years old. She also say e subsequently “blackball” – blacklist- her for di modelling world.

April Lampros, wey say she meet Combs as a student for New York Fashion Institute of Technology for 1994, tok about “four terrifying sexual encounters” for di early 2000s.

Adria English, One former adult-film actress wey work with Combs for di 2000s, say e bin use her as a “sexual pawn for di pleasure and financial benefit of odas” during di “White Parties” e host for im homes for New York and Miami.

Dawn Richards, wey once sing in two Combs-assembled groups including Danity Kane, say she bin personally witness im violence against Ms Ventura and say e bin threaten her life wen she try to intervene.

Thalia Graves, wey dey backed by celebrity lawyer Gloria Allred, claim say Combs and im bodyguard Joseph Sherman bin sedate, overpower and tie her up before recording themselves raping her and later distributing di sex tape.

Representatives for Combs don deny di claims of all six most recent accusers.

Source