John Cena don announce retirement from wrestling

John Cena

Getty Images

American actor and wrestler John Cena don announce say e dey retire from competing for di World Wrestling Entertainment (WWE) events.

Cena make di surprise announcement to fans wen e show for di WWE Money in di Bank event for Canada.

Di 47 year old wey start to dey act 18 years ago, say im final in ring competition go happun for 2025 as part of im farewell tour.

Cena wey pipo sabi as one of di greatest professional wrestlers of all time and don win world champion 16 times since e join di WWE for 2001.

E tell fans for Toronto say, “Today finally announce my retirement from di WWE”.

Im shocked fans manage later hala “thank you Cena.”

E make dis announcement as im wear shirt wey tok say, “Di Last Time Is Now” and im trade mark “jorts”, e thank WWE fans say dem “let me play for di house wey una build for many years.”

For press conference wey im do later, e reveal say im go like remain for di WWE family in some way, even though im feel like say e dey “at my end” physically.

John Cena start to dey act for 2006 wen e act for The Marine bifor im land big budget feem roles for feems wey include, The Suicide Squad, Fast & Furious 9 and Teenage Mutant Ninja Turtles.

Di star don stil dey run part time doings wit di WWE even afta im career blow for 2018.

E go viral dis year afta e wear nothing but envelope for Academy Awards skit dis year.

Di celebrity na also who pikin dey ask for pass for all time from di charity Make-A-Wish.

E get Guiness World Record for di number of wishes wey im don grant to Make -A-Wish pikin dem wey get critical sickness.

Source