WAEC release May/June 2024 WASSCE results, tell candidates how to check am

Students siddon for exam hall

Getty Images

Di management of di West African Examinations Council (WAEC) don release results of di May/June 2024 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) on Monday, 12 August.

WAEC make di announcement on dia official X account and tok say candidates fit access dia results via dia website.

Na 1,814,736 candidates wey dey 25,126 secondary schools for Nigeria bin register for di exam.

How candidates take perform

Of di number, na 1,805,216 candidates sidon for di exam. Di exam also dey administered to candidates from some schools for Benin Republic, Cote d’Ivoire and Equatorial Guinea, wia dem dey use Nigerian Senior Secondary School curriculum.

Out of di total number of candidates wey write di exam for Nigeria, 1,685,889 candidates, wey represent 93.39% get dia results fully processed and released while 119,327 candidates, wey represent 6.61% get one or more of dia subjects still dey processed.

Dis na sake of some issues wey we dem dey resolve, WAEC tok.

“Efforts dey go on to sharpaly release di results within days, di exam bodi add.

Analysis of statistics of candidates performance for di exam show say out of di 1,805,216 candidates wey sidon for di exam, 1,332,089 candidates, wey represent 73.79%, gbab credit and above for minimum of any five subjects.

Dis na wit or witout English Language and/ or Mathematics.

1,301,941 candidates, wey represent 72.12%, gbab credits and above for minimum of five (5) subjects, including English Language and Mathematics.

Of dis number, 628,820 wey be 48.30% be male candidates, 673,121 wey be 51.70% na female candidates.

Dis year record 7.69% decrease for performance if we compare am to last year.

“Di percentage of candidates for di category in WASSCE for School 2023 and 2024, show say dis year (2024) WASSCE get 7.69% decrease for performance”.

Dat na to say dose wey gbab credit and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, be 79.81% den.

Di results of 215,267 candidates, wey represent 11.92% of di total number of candidates dey withheld sake of connect wit different reported cases of exam malpractice. Dis na 4.37% lower dan di 16.29% wey dey recorded for di WASSCE for School Candidates, 2023.

WAEC officials dey mark candidates scripts?

No be WAEC dey mark students examination paper, na examiners WAEC dey appoint to mark di scripts.

So who be dis examiners?

Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey know classroom work well-well.

To ensure say mago-mago no dey for di grading system, WAEC dey set up Committee of experts wey go come up wit di marking guide.

Na dem go drill all di appointed examiners well-well on all aspects of di marking scheme for one marking exercise wey dem dey call co-ordination.

Even wen di actual marking start, dem no dey leave di examiners on dia own.

Dem dey organise dem into small groups, each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.

Na di Team Leader dey check and vet di group members marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines.

Di Team Leaders demsefs dey supervised by more experienced examiners wey dem dey call Chief Examiners.

Wen dem don mark finish, WAEC go still employ anoda group of pipo – dem dey call dose ones Checkers.

Di main role of Checkers na to make sure say all di marks wey di examiners give dem record am correctly and dem transfer am to di right score sheets.

WAEC no dey reveal di identity of di examiners wey dem dey use to mark di exam papers.

We go update dis tori once WAEC release di result.

Source