‘Ova 12 million pipo dey starve’ for war-hit Sudan – WHO

War-hit Sudan

Getty Images

Hunger dey worry pipo well-well for Sudan wia dem dey fight war.

According to di World Health Organization (WHO) di hunger “dey almost evriwia”, na wetin di head of di World Health Organization (WHO) tell di BBC Today programme afta e visit di kontri kontri.

“Di situation for Sudan dey very serious… di big displacement – na di largest for di world now, and, of course, including famine,” director-general Tedros Adhanom Ghebreyesus tok.

Im say 12 million pipo dey already displaced, im add say di attention of di global community to Sudan dey “really low” and race na one of di factors wey dey cause am..

Thousands of pipo don die since di civil war start for April 2023 between Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF).

“Imagine: destruction, displacement, diseases evriwia, and now famine (hunger and starvation) too,” Dr Tedros tell di BBC.

Im tok say im bin don visit one camp recently for di internally displaced pipo and one hospital for Sudan.

“You see say many of dia pikin skin and bone, don slim”.

Close to 25 million pipo – half of Sudan population – “need support”, Dr Tedros tok.

Im add say Sudan “no dey get di attention wey dem deserve”, and na di same case wit oda recent kasala for Africa.

“I tink say race (colour) na wetin dey on display for hia. Na wetin I dey feel now. We dey see di pattern now.”

Dr Tedros – wey bin grow up during war for Ethiopia – say: “Especially for Africa, I tink dey attention dey really, really low.”

“Na di sad part be dat, becos wey dey see am repeatedly, no bi only for Sudan,” im add.

“I sabi di smell of war, di image of war, di sound of war,” di WHO chief oga tok.

“From that, I fit understand di impact e dey get on odas, and I remember as my mother bin dey pray make I survive a day at a time – growing up, to survive in a day na big tin, I see di same tin for Sudan and Gaza.”

Sake of Russia invasion of Ukraine for 2022, Dr Tedros say di world no give “equal attention to black and white lives”.

At di time, im explain in detail say only small part of di aid wey di world bin give to Ukraine, na im dem give to oda humanitarian crises.

Tigray for Ethiopia, no dey get di same humanitarian treatment like Yemen, Afghanistan and Syria.

Dr Tedros beg di mainstream media to give more attention to Sudan, im describe di situation for dia as “tragedy”.

For August, one UN-backed committee of experts bin declare famine (starvation) for one camp wey dey house about 500,000 displaced pipo near di occupied city of el-Fasher for Darfur, one of di regions wey worstly affected by di fight.

Di leader of Sudan army, Gen Abdel Fattah al-Burhan, and di head of di RSF, Mohamed Hamdan Dagalo, collabo to stage one coup for 2021, but kasala happun between dem wey later make Sudan enta into civil war last year.

Dem sama di United Arab Emirates (UAE) accuse of supporting di RSF wit money and guns – wey dem deny – while dem also tok say Saudi Arabia get close ties with di Sudanese goment.

Plenty efforts wey Saudi Arabia and di US don try to use to settle dem no fit end di kasala between dem..

Source