Michael Jackson broda – Tito Jackson die at 70

Late Tito Jackson smiling wit headphone for im ear

Getty Images

Tito Jackson wey be one of di original member of di Jackson 5 pop group

don die for di age of 70.

Tito Jackson na broda to di late pop star Michael Jackson.

Sadly, no official cause of death don dey determined yet

Tito bin perform for di ogbonge popular group wit brodas wey include Jackie, Jermaine, Marlon and Michael, wey die for 2009.

Bifor di tori of im death, Tito bin dey Munich to prepare for di performance wey di group dey due to give.

Steve Manning, wey be a long-time Jackson family friend and former manager for di Jackson family bin tell Entertainment Tonight say Tito Jackson die on Monday.

Di news dey confamed for one Instagram post by Jackson three sons, Taj, Taryll and TJ Jackson. Even di three sons demsef na R’n’B/pop artiste dem be, known as di 3T for di 1990s.

According to di three sons, dem describe di death of Tito Jackson as shocking while dem also call am caring father.

“We dey shocked, saddened and heartbroken,” dem write. “Our father na incredible man wey care about everione and dia well-being.”

“We go really miss am. E go be foreva ‘Tito Time’ for us. Please rememba to do wetin our father dey always preach and dat na ‘Love One Another’. We love you Pops.”

Tito Jackson and di Jackson 5

Di Jackson 5 hits bin include ‘ABC, The Love You Save and I Want You Back’.

Na 1964 dem bin form di group wia Tito bin dey play di guitar and also provide backing vocals.

Jackson 5 don sell more dan 150 million records worldwide.

For 1980, di siblings bin collect a star for di Hollywood Walk of Fame. By 1997, di Jackson 5 dey inducted into di Rock and Roll Hall of Fame.

Bifor Tito bin die, e post a message for social media from Munich, Germany, wia e wit im brodas bin visit a memorial place wey dem dedicate to im broda Michael Jackson.

Di Jacksons perform for Germany on 10 September, afta dem perform for Boogietown, one UK music festival celebrating funk, soul and disco for Surrey.

Di siblings bin also perform for di ‘Fool in Love Festival’ for Hollywood Park Grounds in Los Angeles on 31 August.

Who be Tito Jackson

Tito na di third oldest Jackson and one of nine children wey dey di family. Di oda siblings na di global star Janet and La Toya Jackson.

Meanwhile, na only Michael Jackson bin don die at di age of 50 for June 2009 out of di Jackson siblings, odas still dey alive

Di papa of di family, Joe Jackson, bin die at di age of 89 for 2018.

Di Jackson group wit performers and singers don produce a total of 27 US number one hits.

Howeva, wit some works for di band, Tito bin also get solo career as blues musician wey e start for 2003.

Tito na di final sibling to place any solo single for di Billboard charts wit di 2016 hit wey be ‘Get It Baby’.

For 2019, Jackie, Tito, Jermaine and Marlon embark on World Tour as ‘Di Jacksons’.

Meanwhile, di Jacksons bin perform several shows for di UK as part of A Celebration of 50 Years and also performing for Glastonbury Festival.

Source