How dozens of Muslim worshippers die on dia way to Eid-el-Maulud celebration

Pipo dey look di vehicle wey involve for di accident

Auwal Muhammad Umar
Traffic collisions dey common for Nigeria as pipo sometimes no dey obey di regulations or rules of di road

Dozens of Muslim worshippers don die for one motor accident for Kaduna state, northern Nigeria.

Di victims bin dey travel to go celebrate Eid-el-Maulud – Prophet Muhammad birthday – for di northern town of Saminaka.

Di bus bin jam one truck wey dey come in front of am near Lere tok, one organiser of di Eid celebration tok.

Dis accident dey come few days afta about 40 pipo including children lose dia lives afta one boat capsize for Gummi town, di headquarters of Gummi Local Government Area of Zamfara State on Saturday, 14 September.

Di Director of Emergency for di Zamfara State Emergency Management Agency (ZEMA), Hassan Dauran, wey tok wit local tori pipo Channels Television tok say di boat bin dey carry about 50 passengers wen di tragic accident happun.

According to Dauran, na only few of di passengers dem rescue alive, while di majority of di passengers, mostly women and children no fit make am alive.

Fatal road accidents dey very common in Nigeria. Both drivers and passengers dey most of di time ignore safety measures, wey authorities dey fail to enforce.

One official for Kaduna State Emergency Management Agency put di number of pipo wey die at 36 on Monday morning.

However, di event organiser, Ahmad Dayyabu wey tok to di BBC put di death toll at 40 and di 31 pipo wey wunjure don dey receive treatment for hospital.

“Dem begin dia journey from di town of Kwandare on dia way to here, Saminaka. As dem reach di town of Lere, one trailer truck run ova dia vehicle,” e tok.

“From our investigation, 71 pipo bin dey inside di ill-fated vehicle.” According to report, di bus carry overload.

More dan 1,470 pipo don die for road accidents across Nigeria for di first quarter of 2024, official statistics show.

Dat na around 16 pipo per day on average.

Nigeria goment bin declare Monday as public holiday to mark dis year Eid-el-Maulud.

Di kontri leader Bola Tinubu don encourage Muslim faithful to dedicate di Maulud holiday to pray for di kontri and show empathy and compassion to one anoda.

Eid-el-Maulud na day to celebrate di birthday of di Prophet Muhammed.

Di actual date of birth of di Prophet no dey clear dat na why Shiá and Sunni Muslims dey celebrate on different days.

Maulud mean birth and dem dey use am to describe di Prophet birth.

Dem born di Prophet Mohammed for Mecca, di kontri wey be Saudi Arabia now for di Georgian calendar year of 570.

Dem dey celebrate Maulud for almost all Islamic kontris and for oda kontris wey get plenty Muslim population, like Ethiopia, India, UK, Turkey, Nigeria, Sri Lanka, France, Germany, Italy, Iraq, Iran, Maldives, Morocco, Jordan, Libya, Russia and Canada.

Dem no dey celebrate am for Qatar and Saudi Arabia as e no dey declared as Public Holiday plus e dey forbidden.

Source